First Half!
Referee don blow whistle for match to start afta Koulibaly and Salah exchange pennants.
Di stakes dey really high for dis one for Tangier.
Morocco defeat Nigeria 4-2 on penalties to reach Afcon 2025 final.
Komla Adom, Tamara Ebiwei, Helen Oyibo
Referee don blow whistle for match to start afta Koulibaly and Salah exchange pennants.
Di stakes dey really high for dis one for Tangier.
Di players dey sing di national anthems now.
Center referee be Pierre Ghislain Atcho wit Boris Marlaise Ditsoga, Styven Moutsassi Moyo, Amos Ndong and Jean-Jacques Ndala as assistant referees for dis game.
Both teams comot for dressing room enta park now. Egypt dey wear dia red jersey as Senegal dey wear dia usual green jersey.
Time don reach now - all eyes go dey on some of di top players for di world – Salah, Marmoush, Sadio Mane, Nicolas Jackson and di rest to lead dia teams to di final.
Di stakes dey high as both teams perform well so far – wey dem sama oda top teams to reach di last four.
Di Pharaohs of Egypt comot defending champions Cote D'Ivoire 3-2 for di quarterfinal while Senegal comot 10-man Mali 1-0.
Football fans dey expect seminal game wey go serve everitin – emotions, fun, pressure, anxiety, drama and many more as some of di world's best players go face each oda.

Wia dis foto come from, BB





Di line up for Egypt vs Senegal don land!
See who dey start for both teams.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, ULRIK PEDERSON/NURPHOTO/VISIONHAUS VIA GETTY IMAGES
Record Afcon title winners Egypt (seven times) dey jam wit Senegal (dem win di title only once) for di first of two semi-final games for di tournament.
Di match na 6:00pm WAT.
Di stakes dey high as both teams don perform well so far – wey dem sama oda top teams to reach di last four.
Di Pharaohs of Egypt comot defending champions Cote D'Ivoire 3-2 for di quarterfinal while Senegal comot 10-man Mali 1-0.
Football fans dey expect a game wey go serve everitin – emotions, fun, pressure, anxiety, drama and many more as some of di world's best players go face each oda.
Una welcome to our coverage of di Afcon 2025 semi-finals matches between Egypt and Senegal and Nigeria and Morocco.
Tonight, Seven times Afcon winner go take on one time winner Senegal.
While di Super Eagles of Nigeria dey face di host, Morocco.
Na hia una go get di tori live as e dey play!
Make una follow us.