Nigeria vs Morocco, Nigeria 0-0 Morocco
2' Nigeria and Morocco dey drag di ball as di match start wit beta action.
Morocco defeat Nigeria 4-2 on penalties to reach Afcon 2025 final.
Komla Adom, Tamara Ebiwei, Helen Oyibo
2' Nigeria and Morocco dey drag di ball as di match start wit beta action.
1' Referee don blow whistle, match don start.
Almost evriwia for di Prince Moulay Abdallah stadium dey shine red sake of Moroccans wey enta di stadium in dia numbers to support di Atlas Lions...





Di Nigeria - Morocco game go hapun for di Prince Moulay Abdallah stadium for Rabat.
Se dis before action and live fotos of di stadium.


Nigeria XI: Nwabali; Osayi-Samuel, Ajayi, Bassey, Onyemaechi; Onyeka, Onyedika, Iwobi; Lookman; Osimhen; Adams.
Morocco XI: Bono; Hakimi, Aguerd, Masina, Mazraoui; El Khannouss, El Aynaoui, Saibari; Diaz, El Kaabi, Ezzalzouli.
Meanwhile, ground don set for si second game of di night.
Supporters of di Super Eagles of Nigeria don show for di Prince Moulay Abdallah stadium wit dia green and white colour.




Egyptian players don dey disappointed wey dem dey cry. Trezeguet, Hossam no fit hide dia emotions. Senegal for di oda hand dey celebrate as Mane dey lead dem.
Di Teranga lions dey di final of di Afcon. Dem go wait for di winner for di second semifinal game between Nigeria and Morocco.
Referee don blow whistle for di end of di game. Senegal win dis one 1-0 to progress to progress to di final.
93"
CHAAANCE!
Omar Marmoush get chance inside di Senegal box wey he don shoot am straight at Mendy. Di Al Hilal keeper don catch am.
92"
Zizo dey try to create sometin for di Pharaohs but everitin dem dey do no dey click. Dem now carry anoda striker enta di game wit few seconds left.
91"
Senegal almost try to create dia second goal. Di final pass neva go through odawise, dem fit kill dis game. Egypt now create chance but Zizo no fit take advantage of di ball inside di area.
90
+ 5"
Dem don add 5 mins to di game now. Egypt fit use dat to get di equalizer? Time go tell.
89"
FREEKICK
Ref blow whistle say Zizo don commit foul against Idrisa Gana Gueye.
87"
Egypt win freekick in front of dia box. Dem pass di ball quick quick wey dem try to create dia own chance now. Di ball dey jump around for di Senegal area. Pressure now dey di Senegal area.
85"
Sadio Mane sit for ground, he dey complain say dem hack im neck. Di game dey continue as Senegal dey fight for all di 50/50 balls.
84"
Senegal now dey make dia own changed. Ndiaye don comot for Ismaila Sarr. Egypt now dey pepper di Senegal area but goalkeeper Mendy catch di ball easily.
82"
SUBS
Moustafa Mohammed enta di game to replace Emam Ashour. Egypt now dey throw everitin for dis game now. Dem win corner. Dem take di cornerkick but di ball dey cleared.
81"
CHAANCE!
Pape Gueye get chance inside di box, he get chance to pass to Mane or Jackson but Gueye shoot by himserf wey di ball go wide.
81"
SUBS
Egypt now dey make changes to bring more attackers. Dem get only 10 mins to redeem diaserf
Afta di VAR check, dem tok di referee say na goal. Senegal take di lead thru Sadio MANE. 1-0