, Nigeria 0-0 Morocco
38' Achraf Hakimi of Morocco fire shot but Nigeria goalkeeper Nwabali punch di ball con catch am.
Morocco defeat Nigeria 4-2 on penalties to reach Afcon 2025 final.
Komla Adom, Tamara Ebiwei, Helen Oyibo
38' Achraf Hakimi of Morocco fire shot but Nigeria goalkeeper Nwabali punch di ball con catch am.
36' Moroccan player donnget injury, e bin dey receive treatment but now e do continue. Players dey warn .
35' Calvin Bassey of Nigeria collect card afta e foilplayer for defence line wey give Morocco corner kick. Achraf Hakimi play am but e land ontop Nigeria goal post.
32'Morocco get freekick afta Akor Adams of Nigeria bring down Morocco player, dem play di ball notin come out.
30' Morocco get corner kick dem play to Nigeria goal area but Osimhen clear di ball to safety. Few second later Morocco head ball to Nigeria goal area but e just cross Nigeria goal post.
27' Bright Osayi of Nigeria pass ball go Morocco area but Morocco defence gallant.
25' Morocco dey play short-short passes to draw Nigeria out, Morocco play long ball but Nigeria defence block am.
23' Bruno of Nigeria no dey allow Morocco top striker Brahim Diaz breathe. E dey follow am back to back.
21' Morocco dey try evritin to break Nigeria defence but Calvin Bassey no dey give dem space.
20' Achaf Hakimi of Morocco play di freekick wey Morocco get afta Osayi of Nigeria foul Hakimi but notin come out.
18' Ademola Lookman bin dey make one counter attack run but like five Moroccan defenders block am.
16'Corner kick for Morocco afta ball deflect from Nigeria player leg, Masina play am but Victor Osimhen of Nigeria head am out to safety.
14' Ademola Lookman of Nigeria fire beta shot wey dey goal bound but Morocco goalkeeper punch di ball out.
13' Throw -in for Morocco, Hakimi play am to di midfield but notin come out.
11' Morocco dey hold di ball since, Akor Adams of Nigeria collect di ball, im run towards Morocco goal area but nobody dey front wey im go give di ball, e leave am for di Morocco defender.
9' Brahim Diaz make anoda attempt as e fire shot from wide range but di ball just cross di Nigerian goal post.
8' Brahim Diaz of Morocco make anoda attempt for Nigeria goal area but Calvin Bassey clear am.
7' Nigeria and Morocco no dey fear each oda dem dey try enta goal area but e neva click.
5' Osayi of Nigeria hold ball, Achraf Hakimi try to collect di ball from im leg but Osayi hold di ball till e gom out of play.
3' Brahim Diaz of Morocco get opportunity to strike by Nigeria defender Semi Ajayi no give am chance as im clear di ball.