SUBS
45"
Both teams don dey make changes. Lamine Camara don enta for Senegal. Trezeguet don replace Fathy for Egypt.
Morocco defeat Nigeria 4-2 on penalties to reach Afcon 2025 final.
Komla Adom, Tamara Ebiwei, Helen Oyibo
45"
Both teams don dey make changes. Lamine Camara don enta for Senegal. Trezeguet don replace Fathy for Egypt.
Both teams don dey comot for tunnel for di second half of dis game now.
Crucial 45 minutes dey up next for dis semifinal game.
For di first half both teams no create any beta chances. Egypt don sit back dey wait for counter. Senegal try to pepper di Pharaohs. Even dem, Jackson and Pape Gueye get half-chances but dem no fit trouble di Egypt goalie El Shenaawy.
49"
HALFTIME
Senegal get anoda corner. Even bifor dem go take di corner, ref don blow whistle for halftime.
47"
Di time almost reach for di first half to end. Senegal dey try to create one more chance bifor dem go blow di whistle.
45"
Freekick to Egypt. Salah put di cross inside di box, but nobody fit connect wit dat ball, di chance don spoil now. Coach Hossam put hand for face as dat chance don vanish.
44"
Senegal make mistake for back, Egypt try to take advantage thru Marmoush but im too don lose di ball. Di chance don vanish.
43"
Two mins to halftime, still no clear chance from any of di teams. Dia coaches get plenty worl to do at halftime. Sadio Mane try to connect wit one ball to cross inside di Egypt area but di ball already don comot for goalkick.
41"
YELLOW CARD
Habib Diarra don collect yellow card, be like he don tok sometin wey di ref no happy about. Di ref now call both coaches to ask dem to warn dia staff for di bench.
41"
Both coaches and dia technical teams don gada dey push each oda. Wetin happun? Sake of dat foulby Salah on Mane. But afta referee try to calm di situation, di two coaches now shake and hug each oda. Game on.
40"
Salah no get any clear sight of goal yet; same wit Marmoush. Senegal don block everywia for defence. Salah finally foul Mane. Ref blow whistle.
37"
Diouf dey ask di fans to chant more afta he cross one ball into di net for jackson but Hossam don block di ball for corner. Diouf play di corner but di ball spoil. Freekick to Egypt for di corner flag afta Jackson don foul Ashour.
36"
Ndiaye dey try to enta di Egypt box wit force, Egypt defender no gree for am. Dem clear di ball.
34"
Di Egypt players surround di ref afta Fathy don foul Diaara. Senegal wan make dem show Fathy yellow card, but di ref don keep his card to his pocket. Game on!
34"
Sadio Mane run to meet one ball ova di top wey he cross di ball inside di box for Jackson - Egypt keeper El Shenaawy don catch am again.
33"
Nicolas Jackson fall for ground inside di Egypt box, he dey want penalty but ref say play on.
31"
CHANCE!
Pape Gueye get one chance inside di box to shoot afta Mane place one pass to am, but again El Shenaaway catch am easy.
30"
So far both teams go get any clear chance to score. Habib Diarra now try to shoot one ball from outside di box, but El Shenaawy don catch am easy.
29"
At di moment, Egypt no dey fit gada dia passes well well. Di one time dem finally beat di Seenegal defence, linesman raise flag for OFFSIDE.