BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
High security alert for Abuja sake of tori of protest by Shiites over US-Israel war wit Iran
Security posts don increase across di Federal Capital Territory and di US embassy don issue warning alerts for dia citizens to stay inside house.
Gafcon 2026 Abuja: Conservative Anglican Bishops gather to chose dia own leader, declare break away from Canterbury
Gafcon na group of conservative Anglican bishops, priests and lay members wey dey against di approval of same sex unions plus oda policies by di church for England.
UK to stop study visas for four countries sake of 'abuse'
Govment go end study visas from Afghanistan, Cameroon, Myanmar and Sudan, sake of wetin UK Home Secretary call abuse.
Tinubu appoint 'Tax man' Taiwo Oyedele as Finance minister
Taiwo Oyedele go replace di former minister of state for finance, Dr Doris Uzoka-Anite wey don go anoda ministry.
In maps: Areas Israel, US and Iran don strike across di Middle East
Israel don launch invasion into Lebanon, while di US embassy for Riyadh dey hit by drones overnight.
Recalled Ghana high commissioner to Nigeria Baba Jamal win Ayawaso East by-election to enta parliament
Recalled Ghana High Commissioner to Nigeria Baba Jamal don win di Ayawaso East by-election, months afta sitting MP don die.
'Nobody see any phone tapping equipment for my papa house' – El-Rufai
Bello El-Rufai son wey also dey represent Kaduna North Federal Constituency say im gatz respond to di tori about ICPC.
Nigeria Shia Muslims hold nationwide protests over death of Iran Supreme Leader
Shia Muslims for Iran and oda places dey see di Supreme Leader as not only di political authority but also as some kain source of religious guidance.
Ginger Me
Special Tori
Wetin countries dey do for dia stranded citizens inside US-Israel war wit Iran
Govments across di world don begin take measures to ensure di safety of dia citizens for di Middle East as conflict for di area continue to spread and intensify.
Two Euracare doctors chop suspension ova death of Chimamanda Adichie son
Euracare Hospital don react to tori say di Medical and Dental Practitioners Investigation Panel for Nigeria don suspend several doctors for dia hospital.
Dem use gold casket bury Mexican drug lord 'El Mencho'
Nemesio Oseguera Cervantes lead di feared Jalisco New Generation Cartel until im death during a firefight in February.
How US-Israel conflict wit Iran fit affect Africa
West African govments don call for restraint and diplomacy following di sudden escalation of conflict for di Middle East, as dem warn of potential economic and security consequences for di region.
Nigeria presidency deny tori say President Bola Tinubu staff try to poison am
Di office of di President of Nigeria don deny tori wey bin dey fly around on top social media say one staff for di presidential kitchen bin wan poison President Bola Tinubu.
Wetin cause di South Sudan 'surprise' attack wey kill almost 200 pipo
Di Ruweng Administrative Area Infromation Minister James Monyluak Mijok describe di attack wey dozens of armed youth run say dme bin come from di neigbouring Unity state and get links to di Sudan People's Liberation Army in Opposition (SPLA-IO).
Epstein try to buy one palace for Morocco days bifor im arrest for 2019
Di disgraced financier bin dey for discussion to buy di luxury palace Bin Ennakhi - but di purchase bin no dey completed.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.










































