'I receive call from my son, King Andre for di first time' - Olakunle Churchill

Olakunle Churchill wear one light blue t-shirt wit one blue cap

Wia dis foto come from, Olakunle Churchill/Instagram

Read am in 6 mins

Olakunle Churchill, di estranged husband of Nigerian actress Tonto Dike don confam say true-true im don settle di differences e get wit im ex-wife.

Di philanthropist for one lengthy post on im official Instagram account acknowledge say di kasala wey happun between dem don end and now dia focus na on co-parenting wit love, care plus shared commitment to raise dia son King Andre.

Oga Churchill also note say dis na di first time im go follow im son tok in nearly a decade. "I dey pleasantly surprised wen I received a call from my son, King Andre, for di first time. Hearing him call me "Daddy" bin dey deeply touching and a reminder say wetin God no fit no exist."

Skip Instagram post, 1
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post, 1

Im post dey come less dan twenty-four hours afta di actress tok say both of dem don settle afta 10 years of bitter public battles.

For one lengthy post she share on her official Instagram page on Saturday, 24 January, di actress tok say peace don return to dia relationship afta nearly a decade of kasala, bitterness and broken communication.

Madam Dike tok say di reconciliation no be by human effort but na God make am possible and di sincere prayer of her pikin wey she born for Oga Churchill.

For im reaction to di post, Oga Churchill say e get how faith take dey bring clarity, humility and peace and add say im acknowledge di growth and grace for di manner in which di mata take settle.

"Wit God leading, healing and understanding don bicom possible. Forgiveness don pave di way for a new chapter and we dey move forward wit a sense of peace and mutual respect."

E also thank di actress wey for long don deny am access to dia son for bin an "amazing mother to im son and for doing a good job."

Tonto Dike reconcile wit ex-husband Olakunle Churchill

Collage of Tonto Dike and her ex-husband Olakunle Churchill. Madam Dike use one white scarf tie her head and she wear one blue shirt, while Oga Churchill wear one black agbada

Wia dis foto come from, BBC/Tonto Dike/IG

Popular Nigerian actress and politician Tonto Dike don announce reconciliation wit her ex-husband Olakunle Churchill afta several years of bitter separation.

For one post she share on her official Instagram page, di actress tok say peace don return to dia relationship afta nearly a decade of kasala, bitterness and broken communication.

"Afta ten long years of public battles, deep wounds, broken communication, bitterness, and pain, God step in. Peace don replace chaos and respect don return di place wia anger bin first live" she write for di post.

Madam Dike add say di reconciliation no be by human effort but na God make am possible and di sincere prayer of her pikin wey she born for Oga Churchill.

"Evri plan of darkness don fail. Stubbornness don bow. Pride don melt. Love don find im voice again for my child," she add.

Skip Instagram post, 2
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post, 2

Di reconciliation dey come afta Tonto Dikeh renewed devotion to Christ.

For di post, Ms Dikeh thank Oga Churchill for choosing peace, she say, "I dey deeply grateful to di father of my child Dr Kunle for yielding to God's word and choosing peace. Obedience to God always birth restoration, even wen di road bin dey long and painful."

She also encourage pipo wey dey face facing similar challenges, say make dem no lose hope, as patience, prayer and faith fit resolve difficult situations.

Oga Churchill neva react to di reconciliation.

Actress Tonto Dikeh and Olakunle Churchill bin marry for 2015 for one high-profile ceremony, but dia union bin no last.

Dia break up bin dey messy and e shake internet at di time sake of claims of abuse, betrayal and violence from Tonto Dike, allegations wey Churchill deny.

Di child wey dem get togeda, King Andre Churchill, bin dey di middle of di prolonged back and forth sake of di issue of custody and welfare.

For one 2019 interview, di ex-husband wey be popular philanthropist for Nigeria, bin tok how dem meet and how di marriage take scata.

"I meet Tonto for my brother birthday party back in 2014, and she get belle three months afta we meet. Wen I met Tonto, I already be one of di most successful young millionaires for Africa," e tok.

E say plenty tins scata di marriage wey range from "several frivolous claims of falsity, domestic violence to false allegations."

E say dem break up for 2016 and clear am say im no ever beat her, as im be proper Yoruba man wey dey disciplined.

Who be Tonto Dike?

Tonto Dike na woman of many parts wey pipo claim see as controversial pesin. Apart from say she be actress, Madam Dike also na politician, she get her own NGO foundation wia she take dey help di less privileged and she bin also try her hands for music at a time.

For 2022, she bin emerge as di deputy govnorship candidate of di African Democratic Congress (ADC) for di 2023 general election for Rivers State.

"Afta series of consultations with leaders of our party, di African Democratic Congress (ADC) for Rivers State and di national level, I happy to announce Ambassador Tonto Dikeh as my running mate for di 2023 gubernatorial election for Rivers State.

"We dey pleased to welcome her to di #RiversRescueMission2023 as we strive to improve di standard of living for evrione in our dear Rivers State."

Tonti Dikeh bin accept di position and say di party dey look forward to invest massively for social protection, to create a social value system for young pipo, increase women inclusion for dia governance system, support small businesses and strengthen traditional institutions, to be active players in di drive to bring sustainable development to di good pipo of Rivers State.

As actress, she don act for many feems, but for 2022, she tell BBC News Pidgin for one interview say she don comot hand kpatakpata for acting feem but she go support di entertainment industry.

She bin also tok for di interview say true-true she dey controversial but na wetin di media don turn her into, ontop question about several times wen she don trend.

But she tok say dem dey misjudge her and di media only delight in reporting di bad tins and dem dey leave out all di beta tins she dey do for communities and di kontri.

"I believe say how you see me, na less of me and more of you, if you get negative opinion about me, I no dey fault you becos we get different opinions." She tok.

Despite controversies wey don surround her marriage and relationships in di past, Tonto tell BBC Pidgin say she go like to marry again but e must be di right pesin.

Who be Olakunle Oladunni Churchill?

Olakunle Churchill na Nigerian businessman and philanthropist. E be di founder of Churchill Group and Churchill Foundation.

Churchill Foundation don donate to orphanages, less privileged and don give scholarships to students for Nigeria.

Oga Churchill don receive plenty awards plus accolades. For 2015, e receive one Nigeria Goodwill Ambassador Award.

Na im grandmother raise am for Ondo State. E be di adopted son of former Nigerian president, Olusegun Obasanjo. Oga Churchill marry Rosaline Meurer for 2021 afta e break up wit Tonto Dike for 2016.