High security alert for Abuja sake of tori of protest by Shiites over US-Israel war wit Iran
Wia dis foto come from, Islamic Movement in Nigeria
Tension dey high for Abuja di Nigerian capital as di Islamic Movement in Nigeria dey plan to do protest sake of di ongoing war for di Middle East betwin di United State of America and dia ally Israel on one hand, and di Islamic Republic of Iran on di oda hand.
IMN na from di Shiite group of Muslims and Iran majorly dey practice Shia Islam.
Di US and Israel dey currently carry out major bombardments against Iran wey start on February 28 afta dem bomb di residence of di Supreme Leader of Iran, Ayatollah Ali Khamenei, and kill am alongside oda top oga dem for di kontri.
In retaliation Iran army don also shoot thousands of missiles and drones to Israel and for oda gulf kontris wia di US get dia military. bases, including Qatar, Bahrain, di United Arab Emirates and even Saudi Arabia.
Hia for Nigeria, di IMN start to dey do protests for several states for Northern Nigeria like Bauchi, Jigawa, Niger and Nasarawa.
Dem don vow to carry di protest into di Federal Capital Territory, but di Nigeria Police don warn against any protest for Abuja.
One tok-tok pesin for di IMN tell di BBC say "we bin hold solidarity protests all ova di North but surely more protests will hapun on Friday".
Dis Wednesday morning for Abuja, BBC News Pidgin tori pesin observe additional security posts as you dey enta into di city centre.
For di Karu axis, along di Abuja-Keffi expressway, addition army Armoured Personnel Carrier (APC) bin position for di od side of di major road, in addition to one military checkpoint wey bin dey dia bifor.
Also just afta di pedestrian bridge for di Mogadishu Cantonment wey pipo know as 'Abacha Barracks', di Nigeria police also block one part of di road wit dia patrol truck.
Inside some parts of di city centre pesin fit also notice di regular patroling of security vehicles as well security operatives wey dey statione for strategic points.
US Embassy cut warning to dia citizens for Nigeria
Earlier, di United States Embassy for Abuja announce say sake of di possibility say protests fit hapun for Abuja, dem don "cancel all visa appointments on Wednesday, March 4, 2026".
"Applicants go dey contacted wit information on how to reschedule," di statement tok.
Di embassy later publish anoda statement wia dem cut warning to evri US citizens for Nigeria say di potential for protest for Abuja on Wednesday dey high, adn dem advise dia citizens for Abuja to remain inside dia house on Wednesday.
"Avoid areas wia protests dey take place. Avoid crowds. Exercise caution if (you find yoursef) unexpectedly for di vicinity of large gatherings or protests. Monitor local media for updates. Be aware of your surroundings. Keep low profile," di embassy tok among oda advise.
Meanwhile di Nigeria Police Force say dem dey ready to "swiftly address any attempt by individuals or groups to exploit global developments to incite unrest or sectarian tension".
"Nigeria no go serve as theatre for foreign conflicts. Any attempt to import external ideological or religious tensions into di country go meet wit di full weight of di law," Banjamin Hundeyin, tok-tok pesin for di police tok for one statement.
Also, di FCT police tok-tok pesin Josephin Ade post one video for her Facebook page wia di FCT Police Commissioner, Miller Dantawaye dey tok to some police officers ahead of di planned protest.
Oga Dantawaye tell im men to follow di rules of engagement and make dem no use dia weapons. "But wen pesin point im own weapon at you, you go dey wait make e use am? No... but I believe say nobody go use any weapon for di protest," e tok.
"Dem say dem dey come out wit two million protesters, well God go help us manage two million pipo, but even if na one hundred thousand pipo come out and dem start to dey violent and harass oda pipo, den we go dey veri professional," oga Dantawaye tok.
Top Tori
Informate me
Di one wey dem dey read well well
Content is not available