Iran Supreme Leader Ayatollah Ali Khamenei wey dey power for over 30 years die for US-Israeli strikes

Iran Supreme National Security Council plus state TV outlets for Iran don confam di death of Ayatollah Khamenei.
Iran state TV announce am wit statement in part, say: "Leader and Imam of di Muslims, His Eminence Ayatollah Seyyed Ali Hosseini Khamenei, on di path of upholding di exaltation of di sacred sanctuary of di Islamic Republic of Iran, drink di sweet, pure drought of martyrdom and join di Supreme Heavenly Kingdom", according to one Reuters translation.
Meanwhile, some Iranians dey celebrate di news say Ayatollah Ali Khamenei kpai inside strikes by US and Israel.
BBC Persian verifiy videos of pipo wey dey celebrate for several cities on Saturday night.
On Sunday morning, most of wetin dey happen for streets be like pro-govment events to mourn di supreme leader death, BBC Persian report – although na still early morning for Iran and dat fit change later in di day.
Footage on di streets for Isfahan for central Iran bin show pipo dey happy and prees dia car horns in jubilation.
Anoda video show pipo wey gada around one bonfire as fireworks light di night sky. Several families of di protesters dem kpai also celebrate for di streets and dia homes.
For inside anoda video, one man dey shout "I dey dream, hello new world!" and pipo fit see as di crowd dey celebrate for di southern Fars province, as dem dey remove one sign of di founder of di Islamic Republic, Ayatollah Ruhollah Khomeini.
End of Di one wey oda users dey read well well
One report by Reuters news agency say celebrations also hapun for Karaj, one city near Tehran.
For Tehran, fotos from news agencies show pipo for streets dey mourn, some hold fotos of Khamenei.
US President Donald Trump na im bin first confam di death of Iran Supreme Leader, Ayatollah Ali Khamenei, hours afta di US and Israel bin launch one large-scale attack on di kontri.
For one statement on im Truth Social on Saturday night, di American leader write say e die for di US-Israeli strikes on Iran.
"Khamenei, one of di most evil pipo for history, don die" E die for di US-Israeli strikes on Iran, e tok.
Oga Trump say dis na "justice" for "di pipo of Iran", Americans, and "pipo from many countries throughout di world"
Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu bin earlier tok say dem don destroy Khamenei Tehran compound for inside "one powerful, surprise strike" and say plenty signs full ground say di 86-year-old cleric don "pass on".
Iranian authorities neva confam Khamenei death, and Iranian news agencies bin report say e tanda "strong and firm in commanding di field".
Iran bin respond to di attack wey US and Israel launch earlier on Saturday, as dem too launch missiles and drones towards Israel and four Gulf Arab countries wey dey host US military bases: Bahrain, Kuwait, Qatar and di UAE.
Khamenei, di hard-line cleric in charge of Iran since 1989

Wia dis foto come from, Getty Images
Ayatollah Ali Khamenei, wey be di supreme leader since 1989, na di most powerful figure for Iran.
E be di head of state and commander-in-chief.
E also get authority ova di national police and di morality police.
Khamenei dey control di Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC), wey dey in charge of internal security, and im volunteer wing, di Basij Resistance Force - wey den use fight dissent for Iran.
Born in di north-eastern city of Mashhad in 1939, di son of a religious scholar, Ali Khamenei bin join di religious opposition movement of Ayatollah Khomeini against Shah Mohammad Reza Pahlavi for 1962.
Di second of eight children for one religious family, im father na mid-ranking cleric from di Shia branch of Islam, di dominant sect for Iran.
Khamenei go later romanticise im "poor but pious" childhood, as e go always say im no dey chop anytin except "bread and raisins".
Most of im education dey based on di study of di Quran, and e qualify as a cleric by di age of 11.
But, as e dey common wit many religious leaders of di time, im work dey as much political as spiritual.
Ogbonge orator, Khamenei join di critics of di Shah of Iran: di monarch wey di Islamic revolution eventually overthrow.
For years, e bin live underground or dey for jail. Shah secret police bin arrest am six times, and e suffer torture and internal exile.
Afta di Islamic revolution, dia leader Ayatollah Ruhollah Khomeini appoint am as di Friday prayer leader of di capital, Tehran.
Every week, dem dey broadcast im political sermons throughout di kontri. E firmly establish Khamenei as part of di new leadership of di kontri.

Wia dis foto come from, Gamma-Rapho via Getty Images
Afta di Islamic Revolution for 1979, Ali Khamenei bin become di deputy defence minister and e help organise di Islamic Revolution Guard Corps (IRGC)
Afta di death of Khomeini for June 1989, di Assembly of Experts (one council of clerics) choose Ali Khamenei to be di new supreme leader, even though e neva achieve di rank wey dey required among Shia clerics as e take dey for constitution - marja-e taqlid (source of emulation) or grand ayatollah.
To correct di situation, dem amend di constitution to say di supreme leader gatz show "Islamic scholarship", wey enable Ali Khamenei to become ayatollah and be selected as supreme leader.
E maintain firm grip on Iran politics and dia armed forces, and e suppress challenges to di ruling system, sometimes violently.
Ayatollah Khamenei don also consistently take hard-line stances on external matters, wey include di ongoing confrontation wit di United States.
E bin remain suspicious of relations wit di West, particularly di US, and also e repeatedly call for di elimination of di State of Israel and e publicly question weda di Holocaust hapun.
Seven presidents of Iran don serve during di rule of Khamenei, wey get six children.













