Dudu Heritage: Bimbo Oshin husband burial photos as family lay am to rest

Dudu Heritage burial
Read am in 1 mins

Di burial of popular Nigerian actress Bimbo Oshin husband, Oladiran Ishola Ibironke wey many pipo sabi as Dudu Heritage don take place for Ibadan, di Oyo-state capital, South-west Nigeria dis Friday.

Plenty Nollywood actors, golfers and celebrities actors turn up for Ibadan Golf Club to pay dia last respect to Dudu Heritage wey be di Captain of Ibadan Golf Club before im death.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

According to reports, di socialite, Oladiran Ishola Ibironke bin slump and die as e dey play golf on September 12, 2021.

Di burial programme start wit tree planting wey be normal golf tradition for di yard of di golf course.

Dudu Heritage burial

Vice-Captain of di club, Tunji Oladosu for inside statement announce say "Im burial activities go begin on October 14 wit Christian wake and Night of Tributes. On Friday, we go plant tree as our tradition for members at a time like dis."

E say di burial of di Nollywood actress husband go dey honoured by golfers from all over di kontri.

Actors wey present for di burial include Adewale Adeoye, wey many pipo sabi as Adewale Elesho, Muyiwa Ademola, Jaiyeola Kuti, Adeniyi Johnson, among odas dey di burial.

Dudu Heritage burial

Plenty pipo for social media don also offer dia condolence to di family and friends of Dudu Heritage.