Wolves vs Arsenal highlight: Odegaard score twice to give di Gunners win

Wia dis foto come from, Getty Images
Premier league leaders Arsenal go celebrate Christmas on top of di Premier League table afta dem win Wolves 2-0 for di final game of Saturday.
While Wolves remain for di bottom of di table and go spend di World Cup break for di relegation zone.
Dem be di division lowest scorers, with eight goals - none of which don come afta di 56th minute.
Dia shot conversion rate of 4.8% na also di worst in di top flight.
See how di game waka
Second Half
FULL TIME!
Di Gunners don win.
Arsenal go into Christmas FIVE points clear for di top of Premier League title.
End of Di one wey oda users dey read well well
Wolves go into di World Cup for break for bottom.
90 mins: SUBSTITUTION
Arsenal bring on Mohamed Elneny, Reiss Nelson and Cedric Soares for Bukayo Saka, Fabio Vieira and Oleksandr Zinchenko.
Four minutes extra time dey added on.
90 mins: Wolves skipper Ruben Neves shoot over di bar.
89 mins: Adama Traore find Daniel Podence, e fire shot but Aaron Ramsdale save am.
86 mins: Adama Traore lift one cross over to Daniel Podence, e no fit get di ball under control with header so e flick am go up and do one sweet bicycle kick wey go just wide.
84 mins: Wolves winger Adama Traore skip past Oleksandr Zinchenko with some nice skill and den blast ball across di six-yard box, past two Wolves players.
83 mins: Wolves Boubacar Traore shoot wide from di edge of di area. E don get fewer touches dan anybody else wey don play di whole game so far.
80 mins: SUBSTITUTION
Wolves bring in Matheus Nunes for defender Toti.
77 mins: Daniel Podence find Goncalo Guedes for di left but e hammer shot inside di side-net.
75 mins: GOAL!
Odegaard score again.
Gabriel Martinelli beat Dexter Lembikisa for di wing side to find Oleksandr Zinchenko.
Im cross dey deflected go Martinelli side, Jose Sa save di shot. But di rebound land give Martin Odegaard, wey bo waste time to blasts di ball in.
72 mins: Wolves Adama Traore foul Gabriel as e run to catch one long ball for front.
71 mins: Aaron Ramsdale don come back on im feet and dey ready to play on.
70 mins: Mikel Arteta dey give im players instructions.
69 mins: Adama Traore and Aaron Ramsdale run enta each other and Arsdi enal keeper need treatment.
67 mins: SUBSTITUTION
Wolves make double change as Daniel Podence and Dexter Lembikisa replace Joao Moutinho and Nelson Semedo.
Na Premier League debut for teenager Lembikisa.
65 mins: Gabriel Jesus control one long ball forward and he dey on his own, no team-mate dey near. Wen e wait tire, e give am to Martin Odegaard wey make di run but Toti slide in to deny am.
64 mins: Adama Traore try to head one high cross but e no touch im head well.
61 mins: Goncalo Guedes shoot down low wit di free-kick from di wing but na easy save for Aaron Ramsdale.
Dis na im first save of di game. In fact the first by either keeper.
60 mins: YELLOW CARD
YELLOW CARD
Arsenal defender Gabriel slide in to take di ball from Adama Traore. E claim say e win di ball, but na lie. E collect Yellow card.
59 mins: Arsenal Gabriel Martinelli injure imself as e dey block one cross.
55 mins: GOAL!
Arsenal don score. Gabriel Jesus find Fabio Vieira wit di ball. Vieira draw goalkeeper Jose Sa before e put di ball across di six-yard box.
Martin Odegaard and Bukayo Saka get open goal to score and Odegaard na im get di ball.

Wia dis foto come from, Getty Images
52 mins: YELLOW CARD
Arsenal midfielder Thomas Partey collect for a foul on Nelson Semedo.
47 mins: Martin Odegaard try to put di ball into di box but Adama Traore and Goncalo Guedes on a counter-attack.
Dem try to do one-two but Aaron Ramsdale collect di ball before Traore reach dia.
46 mins: SECOND HALF
KICK OFF
Wolves 0-0 Arsenal
KICK-OFF!
1 min: Wolves 0-0 Arsenal
Di game don start. Di bottom dey face di top for di Premier League. Na 24 points dey between di teams afta just 13/14 games.
3 mins: Xhaka dey collect treatment. E be like say e dey sick. Arteta dey tok to im players.
Xhaka go back on.
5 mins: Gabriel Jesus goal dey disallowed for offside.
Di Gunners striker dey about two yards off as e control one ball into di box and and put am inside di net.
6 mins: Wolves winger Adama Traore try to run through di middle. E beat some defenders but Gabriel Martinelli tackle am.
8 mins: Wolves cut pass Arsenal but Goncalo Guedes dey offside for di centre. William Saliba stop am and di move for fit lead to penalty if e no be offside.
12 mins: Ruben Neves pass di ball to Nelson Semedo, but Oleksandr Zinchenko block di cross. And Wolves get corner. Dem play am to anoda corner and e go all di way back to Jose Sa.
14 mins: Bukayo Saka play one-two and im cross dey deflected towards di top corner. Jose Sa put am out for a corner. Dem almost get chance dia.
15 mins: SUBSTITUTION
Granit Xhaka go out for Fabio Vieira afta dat im early sickness. E point to im stomach as e dey go off.
21 mins: Beta counter from Wolves and Goncalo Guedes get a chance to score.
Arsenal left-back Oleksandr Zinchenko throw imself at di pass to stop am but e make di mata worse as e give di ball to Wolves - and e dey out of position.
Toti run forward and pass am to Guedes, wey carri am run but e go over di bar.
23 mins: Arsenal striker Gabriel Jesus try to do sometin but Max Kilman tackle am before e fit shoot.
24 mins: Good one for di Gunners. Ben White cross di ball but dem play am comot from Gabriel Martinelli reach.
Gabriel Jesus also try from one left-wing cross but e also no work out.
27 mins: Arsenal defender Ben White tink say e suppose get acorner and kicks di ball comot. Stuart Attwell go tok to am but e no book am.
29 mins: Arsenal captain Martin Odegaard drag Wolves midfielder Joao Moutinho back and e dey lucky to avoid yellow card.
31 mins: Arsenal midfielder Thomas Partey play throw-in but e dey headed behind by Ruben Neves for a corner.
33 mins: Max Kilman head away di corner. E don play well so far.
35 mins: Good play by Boubacar Traore to cut out one Gabriel pass and start a swift Wolves attack but it fizzles out really.
36 mins: Best chance of di game so far as Bukayo Saka play one perfect through ball to Gabriel Jesus, wey cut in and fire shot wey hit di bar. Even though even thoug sha.
Di replay show say Jesus fit dey offside. So VAR for check am if e bin enta.
38 mins: YELLOW CARD
Wolves Toti na di first man wey collect.
Wolves point out say Arsenal too suppose don collect too.
40 mins: England Ben White pass to Brazil Gabriel Jesus for di back post but im volley go wide.
41 mins: Adama Traore collect ball on di edge of di box and fire shot over di bar.
44 mins: Oleksandr Zinchenko dey penalised for a foul throw.
45 mins: INJURY TIME
Two minutes extra time.
45+2 mins: YELLOW CARD
Wolves Boubacar Traore tackle Gabriel Jesus and collect yellow.
HALF TIME!
Wolves 0-0 Arsenal at half time.
Team news

Caretaker manager Steve Davis make two changes to di Wolves team.
Adama Traore keep im place afta starting for di Carabao Cup win over Leeds for midweek while Toti also come in.
Wolves XI: Sa, Semedo, Collins, Kilman, Toti, Bueno, B Traore, Neves, Moutinho, Guedes, A Traore.
Subs: Sarkic, Ait-Nouri, Podence, Mosquera, Ronan, Matheus Nunes, Hodge, Campbell, Lembikisa.

Arsenal no change as Mikel Arteta keep faith with di side wey begin di 1-0 win for Stamford Bridge for dia last league outing.
Arsenal XI: Ramsdale, White, Saliba, Gabriel, Zinchenko, Partey, Xhaka, Odegaard, Saka, Jesus, Martinelli.
Subs: Turner, Tierney, Nketiah, Holding, Cedric, Vieira, Nelson, Elneny, Marquinhos.












