Why Nigerian authorities declare Speed Darlington wanted

Nigeria Content creator Darlington Okoye aka Speed Darlington

Wia dis foto come from, Darlington Okoye instagram

Wetin we call dis foto, Nigeria Content creator Darlington Okoye aka Speed Darlington
Read am in 4 mins

Di National Agency for di Prohibition of Trafficking In Persons (Naptip) don declare Nigerian Content creator, Darlington Okoye wanted.

Di anti-trafficking and sexual abuse agency declare Darlington wey pipo sabi as Speed Darlington, wanted in connection wit alleged offences wey include rape, cyberbullying, and cyberstalking.

Dis dey come afta Naptip bin invite di rapper and content creator to come ansa questions on top accuse wia e admit say im bin sexually abuse pikin.

Im wahala start sake of video wey im use im hand post for Instagram live wia e allegedly confess say im bin abuse 15-year-old girl.

Dat time, e bin no clear weda e dey serious wit di comment or e just dey do content.

Pipo begin drag Naptip put inside di mata sake of say dem want Naptip to torchlight di mata.

Speed Darlington bin come for social media tok about di time wey im allegedly sleep wit 15 year old pikin for one hotel and e "disvirgin her and give am 2k".

Wen pipo first drag Naptip attention to di trending video, di agency bin direct di mata to di Lagos State Domestic and Sexual Violence Agency (DSVA) bifor dem decide to handle di case by demsefs.

But dis time di agency say if anybody see am make dem report to dem.

Speed Darlington and controversy

Speed Darling dey always enta tori sake of tins wey dey controversial. E neva tey wey im comot from police hand bifor dis gbege.

Police bin detain am sake of defamation case against Burna Boy becos of video wey blow afta US rapper Diddy arrest.

For one one viral video wey bin spread ontop social media, e show wia Speed Darlington dey ask Burna Boy how e take win im Grammy award for 2021.

Di 39-year-old wey pipo sabi as Akpi ask di Grammy award winner, Burna Boy, if Diddy rub "oil for im yansh" bifor e win di trophy.

"E no tey afta Burna Boy post im foto wit Diddy na im e win Grammy," e tok

"I just dey wonder, Burna Boy I dey ask you question. No vex . How many oil Diddy drop for your yansh bifor dem give you trophy."

Video of im arrest bin trend ontop social media, afta some pipo escort am comot from im gate.

Meanwhile, di main pipo behind di arrest of Akpi no come out come tok.

Afrobeats giant Burna Boy wey evribodi call im name no also chook mouth for di mata.

Who be Speed Darlington

Speed Darlington na di son of Nigeria singer Pericoma Okoye, wey die on 16 February 2017 for Okigwe, Imo state, southest Nigeria. Im mama na Queen Theresa Onuorah.

E blow for Nigeria afta im song BangDadaDang! comot for 2017 and pipo start to dey meme am for social media.

E even tok say na Diddy bin inspire dat im song wen im drop am.

Dat song blow sotay pipo even start to dey play am inside clubs and parties at di time and na wen Speed Darlington start im social media career.

At di time wey e get im first hit, im bin dey live for di US but a few years later, e come relocate back to Nigeria.

Di 39 -year-old rapper dey veri popular for im social media persona wey im dey take tok about a lot of issues, mostly sex and how to make money.