Uefa Champions League table: Arsenal top table, Bayern and odas battle for top eight
Wia dis foto come from, Kristian Skeie - UEFA)
Di Uefa Champions League don dey take shape small-small, as di league phase dey progress.
Afta matchday seven Premier League side Arsenal dey lead wit 21 points. Bayern Munich dey second wit 18 points while Real Madrid na third with 15 points.
Liverpool, Tottenham, PSG and Newcastle make up di top seven.
Chelsea manage enta top eight position afta dem beat Pafos 1-0 on Wednesday night.
Newcastle shine too as dem sma PSV 3-0
Barcelona, Sporting CP and Manchester City dey for di second half of di table.
Tin no too dey well wit Manchester City afta im loss to Bodo/Glimt.
For post match interview di multiple Champions League winner say "tin neva dey work well wit im team".
Wia dis foto come from, BBC Sport
Wia dis foto come from, Michael Regan - UEFA/UEFA via Getty Images)
Bodo/Glimt bin knack 2023 Champions Manchester City akpako as dem sama dem 3-1.
Dis na di first ever win wey Bodo/Glimt don get for dia Champions League campaign for dis history.
Guardiola add say nine of im important players bin no dey and dem dey give more consistency wen dem dey, I no feel say din team no well, i no agree with dat."
For Bodo/glimt body dey sweet dem as dem record dia first ever Champions League win for dia history.
Di Nowergian club don dey exist since 1916. Dis season dem don play seven matches and dem lose three, draw three and win one.
Na just 10 years ago, wey Bodo/Glimt bin dey compete for di second tier of Norwegian football. Since den, dem just dey improve.
Dem become champions of dia league four times for di past six years and runners-up two times.
Dem qualify dis season to reach di main stage of di Champions League for di first time.
Wia dis foto come from, BBC Sport
Wia dis foto come from, BBC Sport
Wia dis foto come from, BBC Sport
Wednesday results change tins for di table as Bayern Munich close di gap between dem and Arsenal.
Action go resume on January 28.
Wia dis foto come from, BBC Sport
Wia dis foto come from, BBC Sport
Tuesday Results
Champions League Table
Premier League side Arsenal balance for top of di table wit 21 points, dem use three point pass Bayern Munich wey dey third.
Tottenham, Paris Saint Germain, Sporting CP, Manchester City, Atalanta, Inter Milan and Atletico Madrid complete di top ten.
Liverpool, Borussioa Dortmund, Chelsea and Barcelona dey di second half of di table.
Top Tori
Informate me
Di one wey dem dey read well well
Content is not available