Actor Terence Stamp wey act as Superman villain die at 87

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

Terence Stamp, wey be di English actor wey act di arch-villain General Zod for Superman films don die at di age of 87.

For im career wey last for 60 years, di Oscar-nominated actor bin act for feems wey include The Adventures of Priscilla, Queen of the Desert, Far From the Madding Crowd and Valkyrie.

Stamp die on Sunday morning, im family tok for statement to Reuters news agency.

"Im leave behind extraordinary body of work, both as actor and a writer wey go continue to touch pipo for years to come," dem tok.

Na on 22 July, 1938 dem born am for Stepney, east London, to working-class parents.

Stamp bin attend grammar school bifor im begin to pursue im career for advertising.

Afta im get scholarship to go to drama school, im becom famous for di 1960s, afta im make im first playing di titular role for Billy Budd, one 1962 feem about one naive young seaman for di 18th century.

Im performance give am Oscar nomination for best supporting actor and Golden Globe for best newcomer.

E no tey, im begin make name for imsef as a villain, wit stand-out performances for Superman and Superman II as General Zod and Sergeant Troy for di 1967 Far From the Madding Crowd.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, 1960s icons: Terence Stamp and di supermodel, Jean Shrimpton

Young Terence interest for acting start to blossom wen im mama bin carry am go di local cinema to see Gary Cooper for Beau Geste, one feem wey bin leave deep impression on am.

Afta im endure di Blitz for east end of London, di Stamp family move to di more genteel Plaistow - wia Terence attend grammar school bifor im get di first of a series of jobs for advertising agencies.

For im autobiography, Stamp Album, im bin remember how im love di life, but im no fit shake off di feeling say im want to be actor.

Pipo bin dey hail Stamp as one of di new wave of actors from working-class backgrounds, like Albert Finney and Tom Courtenay, wey bin dey also make name for demsefs.

For 1965, Stamp act for one adaptation of di John Fowles novel The Collector, as di oppressed Frederick Clegg wey kidnap one girl and put her for prison for im cellar.

By now, pipo don dey see am regularly for di most fashionable gatherings for di 1960s and im good looks bring plenty female attention.

Im bin get relationship wit actress Julie Christie, wey im bin approach afta im bin see her dey hold gun for one magazine cover for 1962.

Di affair bin only last for one year, but di Kinks later immortalise am for di song Waterloo Sunset: wit a line wey reference Terry and Julie crossing ova di river.

Wit cinematographer Nicholas Roeg, Stamp bin help choreograph di famous fencing demonstration scene: for wia Sergeant Troy sword skills captivate - and eventually seduce - Bathsheba Everdene.

But di film bin get poor reviews and fail for box office. And Stamp bin fall out wit di director, John Schlesinger.

"Im bin no strike me as a guy wey bin dey particularly interested in film," di actor recall. "Plus I no be im first choice: im bin really want Jon Voight."

For 2002, im marry for di first time at di age of 64.

Stamp bin meet Elizabeth O'Rourke for one chemist shop for Australia. She bin dey 35 years younger, and di marriage last for six years.