Muslims around di world dey celebrate Salah festival Eid Mubarak

Wia dis foto come from, Nurettin Boydak/Anadolu via Getty Images

Read am in 5 mins

All around di world, Muslim faithful dey celebrate Eid-el-Kabir wey dem also sabi as Eid al-Adha or di Festival of Sacrifice.

Dis holiday na one of di most important for di Islamic faithful.

Plenti Muslims sabi say di day na to commemorate di willingness of Prophet Ibrahim (Abraham) to sacrifice im son Ismail (Ishmael) as act of obedience to Allah command, but dem believe say Allah bin provide ram for di sacrifice instead.

One ogbonge tin about di festival na di special prayers wey come wit feasting, and di ritual slaughter of animals such as sheep, goats, cows, or camels, especially ram.

Dem go come distribute di meat from di sacrificed animals among family, friends, and di less privileged.

Dem dey use dis as sign of charity, community help, and obedience to God.

Wia dis foto come from, Mostafa Alkharouf/Anadolu via Getty Images

Wetin we call dis foto, Some Palestinians arrive to perform Eid al-Adha prayer for di Al Aqsa Mosque for Old City of Jerusalem on 6 June, 2025.

Across different kontris, Muslims don come out to go pray for mosque in large numbers to do special prayers.

Dressed in shining clothes and colourful attire, smile full dia faces as dem greet each other.

Dis na how ogbonge pictures show us how dem celebrate di Salah festival for some kontris:

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Muslims gada to perform Eid al-Adha prayer for di field for Babile region of Harar City, Ethiopia on 6 June, 2025

Wia dis foto come from, Houssam Shbaro/Anadolu via Getty Images

Wetin we call dis foto, Muslims gada to perform Eid al-Adha prayer for Mohammad Al Amin Mosque for Beirut, capital city of Lebanon on 6 June, 2025

Wia dis foto come from, Nurettin Boydak/Anadolu via Getty Images

Wetin we call dis foto, Muslims gada to perform Eid al-Adha prayer for di field for Babile region of Harar City, Ethiopia on 6 June, 2025

Wia dis foto come from, Hasan Belal/Anadolu via Getty Images

Wetin we call dis foto, Dis na view of Umayyad Mosque as Muslims greet each oda and gada to perform di first Eid al-Adha prayer afta di fall of di Bashar al-Assad regime for Damascus, capital city of Syria on 6 June, 2025

Wia dis foto come from, Saeed M. M. T. Jaras/Anadolu via Getty Images

Wetin we call dis foto, Dis na displaced Palestinians wey dey live for makeshift tents of Al-Katiba neighbourhood as dem gada to perform Eid al-Adha prayers for Gaza City, Gaza on 6 June 2025

Why animal sacrifice dey hapun for di festival

Wia dis foto come from, Gautam Bose via Getty Images

Wetin we call dis foto, Traders wait for customers for di biggest goat market for Kolkata, India, on 2 June, 2025, during di Eid Ul-Adha, di Muslim festival known as di ''Festival of Sacrifice.'

Di Muslim festival of Eid Al-Adha - or Festival of Sacrifice na to rememba prophet Ibrahim willingness to sacrifice im son Ibrahim, wey dey known as Abraham for Christianity and Judaism.

Di belief be say Prophet Ibrahim bin get one dream wey e take as message from Allah, say make e sacrifice im son Ismail as act of obedience.

Wen im tell im son di mesaage, Ismail bin gree and ask im papa to obey di command. As Ibrahim wan kill im son, Allah bin stop am and give am one 'ram' (sheep) to sacrifice instead.

Muslims around di world for ritual dey sacrifice different types of livestock. Traditionally, di act dey compulsory if pesin get di moni wey pass im or her need.

Wia dis foto come from, ADEK BERRY/AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Muslims take part for di flag-raising ceremony and listen to China national anthem bifor dem offer Eid Al-Adha special prayers for one mosque for Beijing on 6 June, 2025.