Morocco defeat Nigeria 4-2 on penalties to reach Afcon 2025 final

Victor Osimhen and Brahim Diaz

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Brahim Diaz of Morocco and Victor Osimhen of Nigeria na di two top scorers for Afcon 2025 wit five and four goals respectively
Read am in 3 mins

Di Super Eagles of Nigeria no go play for di 2025 Afcon final afta di hosts Atlas Lions of Morocco beat dem 4-2 on penalties for di semi-final

Di match wey hapun on Wednesday tough well-well as e get plenti action.

Morocco dominate di stats for open play but di two kontris no fit find di net afta 120 minutes as extra-time too no bring any goal, na penalties settle di mata

Morocco go face Senegal for di final while Nigeria and Egypt go jam for di third place match on Saturday.

Dis go be Morocco first final since 2004 while Nigeria bin finish second for di last edition.

Head to head stats

Overall, Nigeria and Morocco bin don meet 11 times, di Atlas Lions bin don win six, di Super Eagles win three and dem draw two times.

For di Africa Cup of Nations, dem bin don meet five times and na still di Morocco side get di upper hand wit three wins against Nigeria two.

Dia first meeting na for di group stage of di 1976 Afcon wia Morocco beat Nigeria 3-1. And dia last meeting before dis na January 2004, also for Afcon group stage, and Morocco win 1-0.

However, di only time wey dem don meet for Afcon semi-final like dis one, na for 19 March,1980, and Nigeria bin win wit one goal by Felix Owolabi a.k.a Owo-blow, for di ninth minute.