Fotos of landmarks for Morocco bifor and afta di earthquake

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, One woman position for front of a partly destroyed mosque for Adassil

As rescuers kontinu to search through di rubble of buildings wey don destroy for Morocco earthquake, di number of pipo wey dey confam say e kill don kontinu to dey rise.

Famous landmarks don destroy, while some bin appear to withstand di 6.8 magnitude quake.

Tinmel Mosque

Wia dis foto come from, Getty Images [top] and Reuters [bottom]

Wetin we call dis foto, Tinmel Mosque wey be historic site for di High Atlas Mountains of Morocco, don dey severely damaged. We show for diz fotos from bifor [ontop] and afta [below] di earthquake

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di UN culture agency Unesco say Tinmel Mosque don dey shortlisted to become a World Heritage Site

Jemaa el-Fna

Wia dis foto come from, Getty Images [top] and Reuters [bottom]

Wetin we call dis foto, Di top image wey dem take bifor di earthquake show di Jemaa el-Fna minaret, wey be one of Marrakesh best known landmarks, and below di same location afta di quake

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Tourists and local pipo waka pass di damaged Jemaa el-Fna minaret afta di deadly earthquake

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Jemmaa el-Fna na bustling tourist attraction for dis foto wey dem take bifor di earthquake

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pipo sleep ontop di pavement of Jemaa el-Fna square for fear of more earthquakes

Kutubiyya Mosque

Wia dis foto come from, X/Twitter [left] & Getty Images [right]

Wetin we call dis foto, Dust dey blow from di top of Marrakesh Kutubiyya Mosque [left] for Marrakesh as di earth shake, while on di right na foto from di same angle wey dem take bifor di quake

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Kutubiyya Mosque be like e dey intact for dis daytime foto wey dem take after di quake