UK to stop study visas for four countries sake of 'abuse'
Wia dis foto come from, Getty Images/Leon Neal
- Author, Jennifer McKiernan
- Role, Political reporter
- Read am in 4 mins
UK govment go stop to dey issue study visas to pipo from Afghanistan, Cameroon, Myanmar and Sudan from March, Home Secretary Shabana Mahmood tok.
She also say UK go stop skilled work visas to Afghanistans.
Di Home Office tok say dem dey take di action sake of wetin dem call widespread visa abuse.
According to official figures, na pipo from di four countries dey mostly make asylum claim afta dem enta di UK to study.
"Di govment dey clamp down on visa abuse so UK go fit maintain dia ability and proud tradition of helping dos wey genuinely dey in need," one govment tok-tok pesin add.
Wia dis foto come from, Reuters
For inside one statement, UK govment tok say asylum claims from pipo wey originally come di kontri legally - to do something like studying – don more dan triple between 2021 and 2025.
Home Office figures show say pipo wey dey claim asylum on di back of study visa make up 13% of all claims currently for di system.
Mahmood tok say she dey "take di extraordinary decision to refuse visas for di nationals wey dey try to exploit our generosity".
End of Di one wey oda users dey read well well
"I go restore order and control to our borders."
Home Office tok say many pipo from di four specified countries bin cite destitution as part of dia asylum claim and add say UK govment currently dey support 16,000 pipo from di four countries.
About 95% of Afghans wey land UK on a study visa later apply for asylum since 2021, while applications by students from Myanmar increase by 16-fold and claims by students from Cameroon and Sudan more dan quadruple.
On why UK wan end work visas for Afghans, di Home Office also cite di large numbers of Afghans wey dey claim asylum for di UK once dia visas expired.
She say dis "na unsustainable threat to UK asylum system".
Mahmood go introduce new legislation to stop di issuing of visas through one Immigration Rules change on Thursday 5 March.
For November, di home secretary bin threaten to shut down all UK visas for Angola, Namibia and di Democratic of Congo unless dia govments agree to take deportations, wey lead to a resumption of returns flights wit all three countries.
Di measures follow di prime minister decision to adopt a more hard-edge approach to diplomacy in response to pressure to reduce immigration from those on di political right, wey include di Conservatives and Reform UK.
Last week, govment bin announce say dem go reduce protection for refugees to 30 months in an attempt to reduce small boat crossings.
In 2025, a total of 41,472 migrants cross di Channel in small boats, wey dey almost 5,000 more dan di previous year.
UK don resettle di sixth largest number of refugees wey di UNCHR refer in di world, wey di Home Office tok say demonstrate di govment commitment to helping dos wey genuinely dey in need.
Di home secretary go give one speech dis week on making di "progressive case" for immigration control.
Last month, about 40 Labour MPs raise concerns about di impact of di proposals to change permanent settlement rights for migrants wey already dey live for UK, as dem describe di retrospective approach as "un-British" and "moving di goalposts".
Dem warn say e fit worsen UK skills shortage, particularly for di care sector.
BBC don contact di Conservatives and di Liberal Democrats for comment.
Top Tori
Informate me
Di one wey dem dey read well well
Content is not available