Who be di gunman wey shoot and kill pipo for New York skyscraper

Wia dis foto come from, CBS
One man wey carry gun enta skyscraper wia plenti offices dey for di heart of New York, kill four pipo bifor e shoot imsef.
Four pipo die for di attack including New York City police officer Didarul Islam, 36, wey dey work as security at di time wey di incident happun - but dem neva identify di oda three victims.
Tori say di gunman drive across US from Las Vegas and police say e be like say e get mental health issues, and dem dey find out why e carry out di act.
Di shooting happun for Monday night wey make pedestrians begin run for cover as police warn dem say one man dey carry gun waka for evening.
Those inside di building begin fear as gunfire dey sound, some even use chairs and tables to block dia doors as dem hide for office.
Di skyscraper na home to di National Football League (NFL), as well as financial giants like Blackstone and KPMG and oda major companies.
According to di New York City Police Commissioner Jessica Tisch, e say di suspect bin act alone.
She tok for press conference say e shoot di fifth victim and e dey "serious but stable condition".
Di police officer wey e shoot dead na Didarul Islam, Bangladeshi immigrant and father of two wit a third child on di way. E bin serve for di New York Police Department (NYPD) for three and a half years.
Anoda of di victims na employee of finance giant Blackstone, wey di company name as Wesley LePatner.
Who be Shane Tamura?
Di attacker na 27-year-old Shane Tamura of Las Vegas.
E waka into one office block for Manhattan Park Avenue on Monday evening wia e open fire for di lobby bifor e take lift go di 33rd floor to continue dey shoot.
Report say e leave note behind wey appear to dey blame di National Football League (NFL) for a brain injury, according to wetin di city Mayor Eric Adams tok.
Di attacker, Tamura of Las Vegas, bin shoot imsef dead afta e open fire for di building wia di American football league get dia headquarters, but e go different part of di building afta e take di wrong lift.
Di gunman carry note wia e blame CTE - brain disease wey dey triggered by head trauma, for im mental illness, Adams tok.
Tamura play football as a teenager during im time for high school for California but e no play for di NFL, ex-teammates tell US media.
How di suspect shoot inside New York office building
Wen di attacker wan enta di building, e shoot di police officer, Islam.
Afta e shoot Islam as e enta di building, Tamura den point gun for one woman wey hide for cover behind pillar.
E come go through di lobby, as e dey spray bullet wey dey hit multiple pipo- including a security guard wey hide behind desk and anoda wey dey close.
One NFL employee dey "seriously injured" for di attack, NFL commissioner Roger Goodell write for im message to staff.
As Tamura wait make elevator come afta e begin dey attack, one woman step comot from di elevator, but di gunman no shoot her, e allow make she pass, according to di Commissioner.
E find way enta di 33rd floor, wia e kill one pesin bifor e waka down di hallway and shoot imsef for chest, di Commissioner tok for Monday night news conference.
Police search di suspect vehicle wey e double-park for outside for front of di building. Dem find multiple magazine rounds and revolver.
Di vehicle dey registered for Nevada to Tamura, wey also be registered gun owner for di state.
Di incident bring parts of Midtown Manhattan and public transportation to stop.
BBC journalist wey dey di scene report say e see several police vehicles and at least one pesin wey get blood for bodi wey dem dey carry for stretcher.
Mayor of New York City, Eric Adams say preliminary investigation show say di gunman mistakenly go di office of Rudin Management, wey get di building.










