Recalled Ghana high commissioner to Nigeria Baba Jamal win Ayawaso East by-election to enta parliament

Wia dis foto come from, JOHNSON ASIEDU NKETIA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Baba Jamal win di election wit more than 60% of di vote
Read am in 3 mins

Former Ghana high commissioner to Nigeria wey president John Mahama don recall am from im post – win di Ayawaso East by-election on Tuesday 3 March.

Baba Jamal bin win wit ova 10,000 votes for di govment party National Democratic Congress (NDC) stronghold.

Experts bin predict say im go win di election wit ova 70% of di votes, but di official results by di electoral commission confam say dem get below 65%.

Di party pipo don dey tok say dem get decent votes despite di low voter turnout.

Official electoral commission results

  • Baba Jamal (NDC) – 10,884
  • Baba Ali Yussif (NPP) – 4009
  • Ibrahim Iddrisu (LPG) - 43
  • Mohammed Umar Sanda (Independent) - 1885
  • David Kanor (independent) – 104
  • Total valid votes: 17,048 (voter population for di constituency be ova 40,000)
  • Rejected ballot: 120

Baba Jamal tok afta di electoral win say im go unite di party and "bring development to di pipo."

Baba Jamal first win di party primaries under controversial circumstances afta im chop accuse say im use TVs, fridge, motorbikes, food items and cash to buy votes for dat primaries.

In fact, im party di NDC investigation show say Baba Jamal and all di oda candidates for di party primaries bin buy votes, even though Ghana electoral law dey against "voter inducement".

President Mahama afta tori comot say oga Baba Jamal bin use money to induce voters, decide to remove am from di role as high commissioner to Nigeria.

Di presidency tok say Baba Jamal wey be public officer gatz to know say to dey use money to induce voters be illegal.

President Mahama already appoint anoda pesin, Baba Sadiq Abdulai Abu as high commissioner to Nigeria.

Baba Sadiq Abdulai Abu be 40-year-old media entrepreneur and political strategist, wey im dey replace Baba Jamal as high commissioner for di Federal Republic of Nigeria.

Wia dis foto come from, GHANA PRESIDENCY

Wetin we call dis foto, Baba Jamal abandon his post as high commissioner for Abuja to return to contest by-election to "serve im pipo for Ayawaso East"

Profile of Baba Jamal, MP-elect

Di 56-year-old lawyer and businessman contest di Akwatia constituency seat as far back as 2008.

Im lose dat election afta dem bin drag di case for court.

Later di next four years in 2012, im finally win di election to represent di pipo of Akwatia for parliament.

Four years later, im lose di contest to represent Akwatia to di opposition NPP candidate Mercy Ama Sey for 2016.

Afta im fail to re-enter parliament, Baba Jamal decide to focus on im law career and oda businesses bifor president Mahama appoint am as high commissioner to Nigeria for September 2025.

Baba Jamal say he dey provide scholarship for young pipo wey he dey give pipo interest-free loans every year to pipo.

"I decide to return to Ghana to contest for di position for MP sake of I want serve my pipo well. No be about money; for my life, I bin dey support many pipo wit fees, business capital, and oda tins."

"I wan develop dis constituency for di pipo," Baba Jamal tok as im hope to win di by-election by ova 70%.

Baba Jamal contest di Ayawaso East primaries for di govment party two times for di past wey im no win until di recent one afta di sitting MP Mahama Naser Toure don die.

Bifor now, im be di high commissioner to Nigeria wey im abandon dat post to contest to represent di pipo of Ayawaso East on di ticket of di govment party, di NDC.

Now im dey return to parliament as MP for Ayawaso East constituency to replace sitting MP Mahama Naser Toure wey die early dis year.

Di govment party di NDC still get 185 seats to form majority in parliament wey di opposition NPP get 87 seats wit 4 independent candidates.