Why US and Israel attack Iran, how Tehran respond and wetin go hapun next?

Wia dis foto come from, Airbus DS 2026

Read am in 10 mins

Iran Supreme Leader Ayatollah Ali Khamenei don die afta Israel and di US launch one "massive" and ongoing attack against Iran leadership and military.

US President Donald Trump don ask Iranian forces to lay down dia arms, and e say make Iran pipo rise up against dia govment.

Iran don respond by firing ballistic missiles and drones for US assets and allies across di region, dem target Israel, Bahrain, Kuwait, Qatar, di United Arab Emirates and Jordan.

On Sunday, Israel tok say dem launch fresh attacks on "di heart of Tehran", as Iranian attacks across di region also continue.

Dis na wetin we know about di latest conflict.

Why US and Israel attack Iran?

Wia dis foto come from, Reuters

Trump tok say di aim of di operation na to "ensure say Iran no get nuclear weapon".

"We go destroy dia missiles and burn down dia missile industry to di ground. Nothing go remain again," e tok for inside one eight-minute video e post on Truth Social on Saturday morning.

E also warn Iran armed forces to lay down dia weapons in return for "complete immunity", or "face certain death".

E come ask Iranian pipo to prepare to overthrow di clerical establishment: "Wen we finish for here, take ova your govment. E go be yours to take. Dis probably go be your only chance for generations."

Di massive military operation – wey di US name Operation Epic Fury – dey come afta weeks of threats from Trump say im go order military action if Iran no agree to one new deal ova dia nuclear programme.

Iran don repeatedly tok say dia nuclear activities dey entirely peaceful.

US military Central Command say dem wan "dismantle di Iranian regime security apparatus, as dem go prioritize locations wey pose imminent threat".

Earlier, Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu say Israel and US bin launch di "operation to remove di existential threat wey di terrorist regime for Iran pose".

Wia dis foto come from, Airbus

Wetin be di latest for Iran?

Reports of explosions for many parts of di country dey reported since Saturday morning, as 24 out of Iran 31 provinces dey hit, according to one tok-tok pesin for di Iranian Red Crescent wey local media quote.

Videos wey dey spread on social media show explosions and black smoke for multiple areas across di kontri, including di capital, Tehran.

Pipo also hear of explosions for Karaj, Isfahan and Qom wey be di centre of di kontri, and Kermanshah for di west.

Locations wey dem reportedly target include Islamic Revolution Guard Corps (IRGC) facilities, air defence capabilities, missile and drone launch sites, and military airfields.

Di Israel Defense Forces (IDF) tok say about 200 fighter jets bin take part for one "extensive attack against di missile array and di defence systems" for western and central Iran.

Di jets simultaneously drop hundreds of munitions on about 500 targets, dem add.

On Saturday evening, Netanyahu for one televised address say "we don destroy di compound of di tyrant Khamenei for di heart of Tehran".

Trump later write on Truth Social: "Khamenei, one of di most evil pipo for History, don die."

Iran Supreme National Security Council confam im death for inside one statement wey several state broadcast channels report on Sunday morning local time.

Reports also say di Office of President Masoud Pezeshkian bin dey targeted for di first wave of strikes.

Iranian state TV say di president dey "safe" and e later put out a statement.

Iran also dey experience near-total internet blackout, wey mean say getting reliable and up-to-date information out of di kontri dey difficult.

Iran Civil Aviation Organisation say dia airspace dey closed until further notice.

More dan 200 pipo don die and more dan 700 dey injured across di kontri, according to di Red Crescent on Saturday.

At least 108 pipo die for inside explosion wey hapun for one school for southern Iran, according to one local prosecutor.

Meanwhile, around 40 Iranian officials don die for di strikes, according to one intelligence source and a military source wey CBS News, BBC US partner cite.

Di IDF name seven senior Iranian defence officials among dos wey die, wey include Iran Defence Council secretary Ali Shamkhani, Defence Minister Brig Gen Aziz Nasirzadeh and IRGC commander Gen Mohammad Pakpour.

Di IRGC don since name a new commander in chief, Ahmad Vahidi.

Wia dis foto come from, Getty Images

How Iran take respond

Wia dis foto come from, Reuters

Iran Foreign Minister Abbas Araghchi don accuse Israel and US say dem launch war wey dey "wholly unprovoked, illegal, and illegitimate".

"Our powerful armed forces don dey ready for dis day and dem go teach di aggressors di lesson dem deserve," e write on X.

Iran don use ballistic missiles and drones to launch wide-scale attacks on US allies and assets across di Gulf, afta dia supreme leader die for di ongoing US-Israel air offensive launched on Saturday morning.

Qatar, Bahrain, Jordan and Kuwait - all home to US military bases – tok say dem intercept missiles fired towards dem, but e be like say falling remains don cause widespread damage.

Di semi-official Tasnim news agency cite di IRGC wey say dia forces don respond to di strikes by hitting multiple sites for Israel plus five major US military facilities for di region - Al Udeid airbase for Qatar, Al Dhafra airbase for di UAE, di US Fifth Fleet headquarters for Bahrain, Ali Al Salem airbase for Kuwait, and Muwaffaq Salti airbase for Jordan.

Di IRGC also tok say one US combat support vessel don come under "severe blows" from missiles, and dem don "completely destroy" one US FP-132 radar system for Qatar.

EU naval mission for di region, EUNAVFOR ASPIDES, meanwhile tok say di IRGC don send radio messages to vessels and warn dem say "no ship dey allowed to pass di Strait of Hormuz" for di Gulf, through which about 20% of global oil and gas shipments dey pass.

Centcom say dia forces don "successfully defend against hundreds of Iranian missile and drone attacks".

Dem add say no US casualties or combat-related injuries dey reported plus damage to US installations for di region dey "minimal and e no affect operations".

For Israel, local media report say Iran launch about 150 ballistic missiles towards Israel, mostly in small salvos, and dozens of attack drones.

Air defence systems intercepted a number of di missiles, while odas strike open areas, dem add.

Di IDF say two Israelis die and 456 injure for Iran retaliatory strikes.

How dem fit choose Khamenei successor?

Following di death of Iran Supreme Leader, Ali Khamenei, di govment don form one temporary council of three men to assume executive authority.

Article 111 of di constitution mandate di formation of temporary three-member council assume di supreme leader duties until di appointment of a new leader.

Di interim leadership council go consist of President Massoud Pezeshkian, Judiciary Chief Gholamhossein Mohseni Ejei and one clerical jurist from di Guardian Council.

Di formal selection of a new Supreme Leader no dey hapun by direct vote but by a body of 88 senior clerics wey dey known as di Assembly of Experts.

Dem dey elect dem by direct vote every eight years.

Under di Iranian Constitution, dis clerics must select di new Supreme Leader as soon as possible, but dis fit prove difficult for safety reasons while di kontri dey under attack.

E dey safe to travel go di region?

Thousands of flights don pause flights to and from di region, for inside one of di most serious disruptions to global travel since di Covid-19 pandemic.

Out of about 4,218 flights scheduled to land for di region on Saturday, dem cancel 966, according to data by aviation analytics company Cirium.

Dem add say dem don already cancel 716 flights out of 4,329 Sunday scheduled flights.

German airline Lufthansa say dem don suspend flights to-and-from Dubai across di weekend, plus for di capital cities of Israel, Lebanon and Oman until 7 March.

Wizz Air too don suspend flights until 7 March for Israel, Dubai and Abu Dhabi and Amman for Jordan.

Virgin Atlantic say dem go temporarily avoid Iraqi airspace, and dem cancel one flight on Saturday from London Heathrow to Dubai.

Kuwait aviation authority tok say dem dey pause all flights to Iran until further notice, according to state media.

Some countries for di region – wey include Iraq and Jordan – don also close dia airspace.

Di UAE say dem don "partially and temporarily" close dia airspace as precaution, state media report.

Meanwhile, di UK Foreign Office travel guidance for Jordan, Syria, Lebanon, Iraq, Yemen, Turkey, Saudi Arabia and Oman, now don advise travellers to "remain vigilant, follow local authority advice and take shelter if advised".

How di attack on Iran take hapun

Wia dis foto come from, Getty Images

Shortly afta 09:30 Tehran time (06:00 GMT), Iranian media bin report explosions for di capital.

Pictures wey BBC see show smoke ova di Jomhouri Square and Hassan Abad Square.

Reports also say pipo hear explosions for multiple oda cities across di kontri, wey include: Isfahan, Qom, Karaj, and Kermanshah.

Authorities don close Iran airspace since di attacks, Tasnim News Agency bin tok.

Meanwhile for Israel, pipo hear sirens dey blow across di kontri at 08:15 local time (06:15 GMT), wey bin alert pipo of di threat of a possible retaliatory missile attack from Iran.

Authorities bin don warn pipo against gatherings and going to school and work unless e dey essential. Di guidance go dey in effect until Monday 20:00.

According to Israeli media, Israel airspace also dey closed to civilian flights.

Trump don describe di operation as "massive and ongoing".

BBC Verify bin locate one video within one kilometre of Leadership House, di office of Iran Supreme Leader, Ayatollah Ali Khamenei.

E bin no dey clear from di video angle if na direct hit on di building.

Anoda verified foto from di same area show thick, dark columns of smoke dey rise above residential buildings and small grocery shops.

Reports also dey of strikes for oda parts of di kontri.

How di world don react

United Nations Human Rights Chief Volker Türk don call for "restraint and implore all parties to see reason, to de-escalate, and to return to di 'negotiating table'".

"I kick against di military strikes wey Israel and di United States of America carry out across Iran dis morning plus di subsequent retaliatory strikes by Iran.

"As always, in any armed conflict, na di civilians dey end up paying di ultimate price," e tok, bifor e remind dos wey dey involved say protecting civilians dey "paramount" under international law.

Di European Union top diplomat Kaja Kallas call di latest developments "perilous".

"Di EU don adopt strong sanctions against Iran and support diplomatic solutions, wey include di nuclear issue," she tok for one statement on X, and add say she don follow Israel plus oda regional foreign ministers tok.

"Protection of civilians and international humanitarian law na priority."

One UK govment tok-tok pesin tok say dem no wan see "further escalation into a wider regional conflict".

"Our immediate priority na di safety of UK nationals for di region," di statement tok, but add say: "We stand ready to protect our interests."

BBC understand say UK no get hand for di US-Israeli strikes.

Germany tok say dem dey informed of di attack in advance and say Chancellor Friedrich Merz bin consult wit relevant security ministers.

Afta one conference call wit ministers and intelligence chiefs, Italian Prime Minister Giorgia Meloni office say dem go consult wit allies and regional leaders to support efforts to ease tensions.

Australia Premier Anthony Albanese tok say im kontri support di US "acting to prevent Iran from obtaining a nuclear weapon and to prevent Iran continuing to threaten international peace and security".

Meanwhile, Russia don condemn US-Israeli strikes on Iran, as dem call am "reckless move".

"E also dey condemnable say dem dey carry out attacks once again under di guise of renewed negotiation process," di foreign ministry tok, referring to di US-Iran nuclear toks wey hapun on Friday.

Di statement also call on di international community to assess wetin dem call "irresponsible actions wey dey aimed at undermining peace, stability, and security" for di region.

Chairperson of di African Union Commission, Mahmoud Ali Youssouf say im dey deeply concerned for wetin dey hapun for Iran.

For statement, e call for restraint, urgent de-escalation, and sustained dialogue, as e stress say all parties must act fully in accordance wit international law and di United Nations Charter to safeguard international peace and security.