How to survive missile attack

Wia dis foto come from, Reuters
Conflict don spread across di Middle East afta Iran Supreme Leader, Ayatollah Ali Khamenei, die for US and Israel attack wey happun on Saturday.
Iran don respond by launching missile and drone across di region, dem dey target Israel, Bahrain, Kuwait, Qatar, di United Arab Emirates, Jordan, Saudi Arabia, Cyprus and ships wey dey pass through di Strait of Hormuz.
Lebanon own Iran-backed Shia Muslim militia group, Hezbollah don join di fight, dem don launch rocket into Israel from dia base for Lebanon.
Israel don respond wit strikes on Hezbollah targets for Lebanon.
But hia na how di US and Israel fight don unfold, how e impact di region and how wetin you go if missile strike your city.
UAE tok say dem don intercept 172 Iranian missiles and 755 drones since Saturday
Di UAE Ministry of Defence tok say dia air defences don destroy 172 missiles since Iran launch start strike for dia region, in respond to US-Israeli strikes on Tehran.
Tok-tok pesin from di ministry tok say dem see total of 186, as 13 of dem dey fall into sea and one oda hit UAE territory.
Di ministry also detect 812 Iranian drones, di tok-tok pesin add, as UAE manage intercept 755 of dem. Fifty-seven land for di kontri.
UAE also detect and destroy eight cruise missiles wey cause some collateral damage and three pipo die wit 68 minor injuries, as well as damage to "civilian facilities".
Bahrain military also release statement say dem don intercept 73 missiles and 91 drones wey dem launch from Iran since Saturday.
Iranian strikes don hit Bahrain, including one wey hit US navy base for di kontri.
Video show blast for central Iran, na weapon company dem target
Video wey dem post online show wetin happun afta dem strike di city of Isfahan for central Iran, BBC Verify don confam.
Di clips show big smoke dey rise from di sky for northern part of di city. For one video wey one pesin dey feem "seriously very loud" explosions and dem target di "optics centre".
BBC Verify don fit locate di smoke for one area near Kaveh Boulevard.
Dat street dey listed as Isfahan Optics address, e dey linked to one company wey dey manufacture Iranian weapons systems, and dem don sanction am from several kontris wey include UK and US.
How ballistic missiles dey work?
Ballistic missiles na long-range weapon wey dem design to deliver conventional or nuclear warheads as dem dey follow ballistic, or curved, path.
Dem go launch am wit powerful rocket engines, and e go shoot upward into upper atmosphere or even space, e dey travel wit high speed.
Once dem cut off di engines, di missile go follow correct path, come re-enter Earth atmosphere for steep descent bifor e go strike im target.
Ballistic missiles travel at extremely high speeds, e dey cover thousands of kilometres in just minutes.
Di speed wey e use travel, dem dey measure am e reach supersonic speed (wey dey faster pass 1,225km/h or 761 miles per hour), while odas, fit dey longer-range, and e fit travel for hypersonic speed – wey dey about (6,125km/h or 3,806mph).
How to survive missile attack - 'Enta inside, stay inside, stay informed'

Wia dis foto come from, AFP PHOTO/KCNA VIA KNS
Since Saturday, residents for Middle-East, Israel, Bahrain, Kuwait, Qatar, di United Arab Emirates, Jordan, Saudi Arabia, Cyprus and Lebanon don dey face missile strike every minutues.
According to one 2018 report dis na how you fit survive missile attack.
- Firstly, try find out if di na truly missile and if di building na concrete. No run. You dey safer inside to di closest strong building.
- Anybody wey dey inside go need cover mouth and nose and runaway from windows to avoid make dem get injuries from di shattered glass
- Also, make sure space dey between you and any missile wey fit fall-out.
- Thirdly, no try enta gutter or fly window as dis dey risky
- Switch on di TV or radio to await information further instructions from authorities.
- Ask for your community if any designated shelters dey available so you go fit build disaster supplies kit wit packaged food, water, a working radio and oda essentials.









