Pictures from Jeff Bezos and Lauren Sanchez wedding for Venice

Wia dis foto come from, Instagram/Reuters

Read am in 6 mins

Lauren Sanchez, 55, wear one lace Dolce & Gabbana haute couture gown for her wedding to Amazon founder Jeff Bezos.

Camera capture her dey smile togeda wit Bezos, 61, after di ceremony, for one picture dem post on Instagram.

Reality stars, actors, royals and some ogbonge A-listers travel to Venice for di ogbonge wedding of Amazon founder Jeff Bezos and TV presenter Lauren Sanchez.

Oprah Winfrey, Orlando Bloom, Kylie Jenner and Ivanka Trump be some of di celebrities wey camera catch for boats and streets of di Italian city on Thursday and Friday.

Di ceremony dey expected to last three days, ending with one big party for di married couple and dia hundreds of guests on Saturday.

Di event bin attract protests from some groups for Venice, including locals wey fight over-tourism to climate change activists.

An estimated 200 pipo bin dey invited to Friday ceremony on di small island of San Giorgio, wia Matteo Bocelli - son of Italian tenor Andrea Bocelli - perform according to reports.

While di exact cost of di wedding no dey known, di estimates range from $20m (£14m) to more dan $50m.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Oprah Winfrey

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Kim Kardashian

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Kendall Jenner and Kylie Jenner

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Jeff Bezos wave from one small motor boat

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Pipo spot Jeff Bezos on im way to San Giorgio island for Venice

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pipo don travel on Venice canals for hundreds of years

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Khloe Kardashian and Kris Jenner

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, US singer-songwriter Usher with American football star Tom Brady

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Activists wey protest for Venice

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Protesters bin try to cause disruption

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Corey Gamble and Kris Jenner

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Khloe Kardashian and Kim Kardashian

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Fashion magazine editor Edward Enninful and Italian model Vittoria Ceretti

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, US tech entrepreneur Bill Gates and partner Paula Hurd

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Hollywood actor Leonardo Dicaprio

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Actor Orlando Bloom

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Jared Kushner and Ivanka Trump, daughter of US President Donald Trump

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Lauren Sanchez and Jeff Bezos inside taxi boat for di city