'Nobody fit bully me' - Seyi Tinubu react to social media influencer King Mitchy controversy

Read am in 6 mins

President Bola Tinubu son, Seyi Tinubu, don react to di allegations wey link am to di gbasgbos between social media influencers Martins Otse wey pipo sabi as VeryDarkMan, VDM and Michelle Mukoro wey pipo sabi as King Mitchy.

For one statement on im Instagram story, di presido son say nobody fit bully am and im no go dignify fiction wit panic.

Di presido son comment dey come for di middle of di ongoing social media gbasgbos between VDM and King Mitchy, two social media influencers wey dey do philanthropy work.

Di tension between di two strong well well and on Saturday morning, one statement allegedly from King Mitchy management post for her social media page say her life dey in danger.

Di tenson begin wen King Mitchy share one school renovation project she finish between six days wey she attribute support of donations from di president son Seyi Tinubu.

In response, VDM enta social media and for im tok suggest say improper relationship or secret arrangements dey between Seyi Tinubu and King Mitchy, wey make am dey sponsor all di projects wey she dey do.

To clear imsef, Oga Tinubu explain say na once im don ever meet King Mitchy and im support her financially wit her NGO activities, as im dey normally do for young Nigerians and organizations wey dey work to empower Nigerians, wey no be crime.

E say wetin dey pain am pass na say dem dey use im name count scores for fight wey im no start or get hand inside.

"For reasons best known to im, VDM appear to dey find way to trigger me, opportunity to attack and attempt to harm my reputation and e seize dis situation to do so. I no go accept dat.

"If my name generate attention, make we at least deal in facts. Supporting charitable causes no be crime. To meet pesin publicly to support dia NGO no be scandal. Repeating falsehoods loudly no change dem into truth."

Mitchy wey dey her 20's post of one school renovation project she carry out for Delta State, Nigeria wia she say she renovate one dilapidated school within six days na im start di gbas gbos.

For one celebratory video she share online, she suggest say di project na proof say meaningful change fit hapun sharparly if di intention dey genuine.

Dis her tok no sweet some pipo belle, as dem perceive am as shade, and dat na wia di gbasgbos start from.

For one of her posts, she write say, "I no ever see pesin wit integrity explain everyday say he/ she get integrity. I do dis for six days to show you how easy e be if you truly wan to sometin."

Although, she no mention anybody name, but di post don trigger sharp response from VeryDarkMan, anoda social media influencer, wey accuse her say dem dey use her as "political pawn to launder di image of President Bola Tinubu administration.

For one video e post on im page, e claim say her intervention for di education sector dey politically motivated.

E also tag di president son, Seyi Tinubu inside one post wey e write on im Instagram page, wey e claim say di current administration no try for di education sector.

Na from di exchange between di two tins escalate to di notice wey Nigerians bin wake up to see for Mitchy social media page wey say she allegedly pass.

"We dey deeply heartbroken to share say our beloved Michele don pass on. Despite all di efforts of di medical team here for Abuja, dem tell us say her condition dey critical and sadly dem no fit revive her," Di statement wey allegedly quote King Mitcy management tok.

Di statement add say "if you no Prime hospital for Abuja, beg dem to do sometin to save her. Her mother don faint for Lagos already and dem don carry her go hospital."

At dis time of dis report, di mata still neva dey clear as no family member nor relevant authorities don confam di report of her death.

Wia dis foto come from, King Mitchy/Instagram story

Wia dis foto come from, Seyi Tinubu/Insta story

Wia dis foto come from, Seyi Tinubu/Insta story

Wia dis foto come from, Seyi Tinubu/Insta story

Prime Care Hospital react to report of social media influencer death for dia facility

Di management of Prime Care Hospital for Abuja quickly come out to debunk di tori. Dem say na fake news, di tori wey dey spread say popular Nigerian content creator and influencer Mukoro Mitchel wey pipo sabi well as King Mitchy allegedly die for dia hospital.

Prime Care Hospital for statement wey dem share wit BBC News Pidgin clear am say King Mitchy no be dia patient and e no die for dia facility.

Dia clarification dey come afta King Mitchy management allegedly release one statement on her Instagram page wey claim say di young philanthropist don pass on.

Prime Care Hospital don tok say dem dey work wit authorities to investigate di source of di misinformation and go take legal action against dos wey dey responsible.

King Mitchy or her management never come out yet to clarify dis mata.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Who be King Mitchy?

According to her profile on her Instagram page, Ms Mitchel na award winning philanthropist and brand influencer.

From funding school renovations to assisting struggling families, she portray di image of a young woman wey dey try help pipo wey dey in need and impact her community.

Her livestream giveaways, surprise outreach visits and documentation of charitable interventions dey attract millions of viewers.

She dey often hail di President son, Seyi Tinubu plus oda ogbonge Nigerians as part of pipo wey support her humanitarian work.

Dis no be di first time wey popular social media content creator dey announce say dem wan kill diasef for social media.

For December 2025, one popular Nigerian TikToker, Peller during im live stream bin say same. E later drive go Lekki-Epe expressway, and threaten to crash im car. Police later arrest am.

Suicide or attempted suicide na still criminal offense for Nigeria.

Skip Facebook post
Allow Facebook content?

Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Facebook post