South Africa react after US expel dia ambassador say e 'no dey welcome'

US Secretary of State Marco Rubio

Wia dis foto come from, Getty Images

    • Author, Rachel Looker
    • Role, BBC News, Washington
  • Read am in 3 mins

US don expel South Africa ambassador to Washington, Secretary of State Marco Rubio say im "no dey welcome for our great kontri".

For one post on X, Rubio accuse Ambassador Ebrahim Rasool say im hate America and President Donald Trump and describe am as a "race-baiting politician".

Di decision dey "regrettable", na so office for South Africa president tok on Saturday, dem add say di kontri still dey committed to build a mutually beneficial relationship wit America.

Dis rare move by US na di latest development for di rising tensions between di two kontris.

For im post on Friday, Rubio bin link one article from di right-wing outlet Breitbart wey bin quote some of Rasool recent remarks wey im make during one online lecture about di Trump administration.

"Wetin Donald Trump dey do na assault on incumbency, those wey dey power, im dey mobilise a supremacism against di incumbency, for home… and abroad," na wetin Rasool tok for di event.

Im add say di Maga movement na response "to very clear data wey show great demographic shifts for USA wia di voting electorate… dey projected to become 48 percent white".

In response, Rubio call Rasool "PERSONA NON GRATA," na Latin phrase for "unwelcome pesin".

Di post from Rubio come as im leave Canada from one meeting wit foreign ministers.

Ties between US and South Africa get as e be since Trump take office.

US president bin sign executive order last month to freeze assistance to South Africa. Di order bin reference "egregious actions" by South Africa and cite "unjust racial discrimination" against white Afrikaners - those wey come from Dutch settlers.

South African goment don deny dis accuse many times.

Di order also reference one new law, di Expropriation Act, wey di order claim say e target Afrikaners by allowing di goment to take away private land.

"As long as South Africa continue to support bad actors for di world stage and allow violent attacks on innocent disfavoured minority farmers, United States go stop aid and assistance to di kontri," according to one statement from White House.

South African goment deny say di law dey related to race, Associated Press bin report.

One fact sheet from White House state say di kontri "blatantly discriminate against ethnic minority descendants of settler groups".

To expel lower-ranking diplomats, dey highly unusual for US to take dat action, come to tok of a more senior official like a foreign ambassador, di Associated Press report, na something wey neither US nor Russia don take dat kain actions against one anoda even wen tension bin dey during di Cold War.

Rasool bin previously serve as di kontri ambassador to US from 2010 to 2015 bifor dem bring am back to di post for 2025.

Dem born am for Cape Town and na dia im grow up. Wen im bin nine, dem comot im and im family wit force from dia apartment wey authorities declare only for white pipo. As im grow older, im pick interest for politics and e say im eviction na significant moment for im upbringing wey guide im future.