Wetin don happun since police confam kidnap of over 100 Church goers for Kaduna

Wia dis foto come from, Copilot
Di Nigerian Police don confirm di report of mass kidnap of worshippers for Kajuru Local Govment Area of Kaduna state.
For statement wey police tok-tok person CSP Benjamin Hundeyin release on Tuesday, e say Kaduna State Security Council meet afta dem receive di report.
"Nigeria Police Force don acknowledge di worry wey pipo get over reports of abduction for Kurmin Wali, one remote community for Kajuru Local Govment Area of Kaduna State," di statement tok
According to di statement, during di meeting wey hold for Govment House, Kaduna, some pipo from di affected local govment area argue say di report wey police earlier tok say no be true.
Police say "di disagreement create confusion and show say dem need to dey careful and verify well bifor making final public statement on such sensitive matter."
Police explain say comment wey Commissioner of Police for Kaduna State Command talk during media interaction na to avoid panic while dem dey still confirm facts.
"Di remarks wey pipo don misinterpret no be denial of di incident, but na careful response while dem dey wait to confirm details from di field, including di identity and number of people wey affect," di statement tok.
Police add say later verification from operational units and intelligence sources confirm say di incident truly happun.
Dem say coordinated security operation don start, as police dey work with oda security agencies to find and safely rescue di victims and restore calm for di area.

Tori wey come out on Monday claim say over 100 pipo bin kidnap by bandits during church service for Kurmin Wali village for Kajuru on Sunday.
One community leader wey escape and also see di attack wit him own eye tok say di gunmen strike during Sunday evening church service, and worshippers no get any chance to run.
"Pipo try run, but dem warn us say if anybodi run, dem go shoot am. Dem don already surround di area," im tell BBC News.
Im say di attackers force worshippers make dem lie down for ground bifor dem begin push plenty of dem enter nearby bush.
"Dem force evri bodi sit down and lie for ground bifor dem push pilo enter bush," im tok.
According to am, at least 177 pipo dem first carry go, though some later manage escape including him.
"Dem first take 177 pipo. Later some return, and 168 still dey with dem. Even me sef I escape afta I hide for one room." im tok.
E add say di bandits thief money and anytin wey get value for di community.
As im dey describe wetin dey happun for di village afta di attack, im say families don dey overwhelmed wit fear and sorrow.
"Pipo dey in fear and dem dey look for dia relatives wey bandits carry" im tok.
One senior church leader even tok say more dan 160 worshippers dem abduct during Sunday service.
Dis na di latest mass kidnap for Nigeria, wia both Christians and Muslims don dey targeted.
Di gangs, wey pipo dey call "bandits" for local area, dey regularly carry out dis kain attacks for northern and central parts of di kontri, mostly to collect ransom.
As dem describe di attack for Sunday, local security tok say gunmen wey carry "sophisticated weapons" burst enter two churches for Kurmin Wali, one forest community for Afogo ward, around 11:25 local time.
"Di attackers come plenty and block di entrance of di churches, force di worshippers comot and carry dem enter bush," Rev Joseph Hayab, chairman of Christian Association of Nigeria (CAN) for northern Nigeria, tell AFP news agency on Monday.
Wen e dey tok to Reuters, Hayab add say: "Information wey reach me from di church elders be say 172 worshippers dem kidnap, while nine pipo manage escape."

Wia dis foto come from, Getty Images
Meanwhile, Amnesty International don call on Nigerian authorities to ensure say all di 166 pipo wey dem abduct from three churches for Kurmin Wali village, Kajuru Local Govment Area of Kaduna State, return safely to dia families.
Di organisation condemn wetin e describe as denial of di incident by police and Kaduna State govment.
Di human rights organisation say "di abducted pipo include minors and pregnant women, for di incident wey happun during church service on Sunday, 18 January 2026."
According to di group, residents of di village and families of di abducted pipo tell Amnesty International say gunmen enter di village and move from one church to another, forcefully carrying worshippers from all three churches.
Amnesty International say di incident don again show failure of authorities to stop killings and abductions for some parts of northern Nigeria.









