Wetin be di Netzarim Corridor wia Israel withdraw troop

Wia dis foto come from, Reuters
- Author, Joe Inwood
- Role, BBC News
- Reporting from, Jerusalem
- Author, Paulin Kola
- Role, BBC News
- Reporting from, London
- Read am in 5 mins
Israeli sojas don withdraw from di Netzarim Corridor - one military zone wey cut off di north of di Gaza Strip from di south.
Hamas na im tok dis one on Sunday, although Israeli authorities never tok anytin about.
Images from tori pipo Reuters show wetin be like Israeli military vehicles dey move away from di coast and towards di Israeli border.
Hundreds of Palestinians for inside cars and on carts wey full wit mattresses plus oda goods don begin return to northern Gaza afta di ceasefire.
Some wey don crossover di corridor describe dia shock afta dem see di destruction of communities and discovering wetin dem say na human remains for areas wia Israeli forces bin withdraw.
Dis Israeli withdrawal dey in line wit di Israel-Hamas ceasefire agreement of 19 January under wey don see to di release of 21 Israeli hostages and 566 Palestinian prisoners so far.
By di end of di first stage of di ceasefire in three weeks' time, e dey expected say dem go don free 33 hostages and 1,900 prisoners. Israel say eight out of di 33 prisoners don die.
Wetin be Netzarim Corridor?
Netzarim Corridor na one area for di Gaza Strip wey bin dey serve as Israel zone of occupation from 2024 to 2025 during di Gaza war.
End of Di one wey oda users dey read well well
Since di early months of di war, Israeli forces bin occupy di roughly 4 mile-long corridor.
Dis corridor split Gaza Strip down for middle, and e dey located just south of Gaza City, come stretch from Gaza-Israel border go Mediterranean Sea.
Di corridor cut off Gaza communities wey dey for north, including di biggest metropolitan area, from di south.
Dem name am afta di site of di former Israeli settlement wey e bin be part of.
Israeli Defence Forces (IDF), bin consider di corridor as important for di raids wey dem do for north and central Gaza.
Dem bin also secure am as e bin be di route wey aid bin follow enta di northern region of di Strip.
Di IDF divisions particularly di 99th Division and 252nd Division bin dey rotate in and out of di corridor.
Wit di latest ceasefire agreement, Israel forces don already reduce dia presence for dia.
Hamas celebrate di withdrawal as victory, and Hamas-run police force dey di area now dey manage flow of Palestinians wey dey cross.
Hamas seize 251 hostages and kill about 1,200 pipo wen dem attack Israel on 7 October 2023, wey trigger di Gaza war.
At least 48,189 Palestinians don die for inside Israel attack, according to Gaza Hamas-run health ministry.
About two-thirds of di building for Gaza don fall or destroy from Israel attacks, UN tok.
About 700,000 residents of northern Gaza bin run go di southern areas for di beginning of di war, wen Israeli military issue mass evacuation orders bifor dem launch ground invasion for Palestinian territory.
Many of di pipo wey relocate bin dey forced to move many times afta Israeli forces enta southern Gaza, too.
Dem no also allow dem return to dia homes through di Netzarim Corridor, wey stretch from di Gaza-Israel border go di Mediterranean Sea.
Israeli forces partially withdraw from di west of di corridor last month and dem allow di first Palestinians - pedestrians – to waka along di coastal Rashid Street as dem cross enta northern Gaza.
Those wey dey drive motor gatz use Salah al-Din Street and undergo screening for weapons by US and Egyptian security contractors.
Di Israel Defense Forces neva officially comment on Sunday withdrawal from di eastern part of di corridor.
Di Haaretz newspaper tok say di Hamas-run Gaza interior ministry don ask pipo to "exercise caution and obey di existing movement guidelines for dia safety".
Di soja withdrawal come as one Israeli delegation dey expected to fly go Qatar wey don dey moderate toks between di two sides for di Gaza war.
Di Israeli government bin tok say di delegation go first discuss "technical matters" wey concern di first phase of di ceasefire deal, instead of di more challenging second phase wey dey meant to lead to permanent ceasefire, di exchange of all remaining living hostages for Gaza for more Palestinian prisoners and complete withdrawal of Israeli forces from Gaza.
Dat go require further direction from Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu, wey currently dey on im way back from the US.
Netanyahu na di first foreign leader to meet US President Donald Trump since e return to di White House on 20 January.
During di trip, for di most dramatic shift in US policy regarding Gaza in decades, Trump bin call for di removal of di territory entire civilian population plus di development of wetin e call "The Riviera of di Middle East".
Dat suggestion, wey be crime under international law, don dey rejected for almost all part of di world, including by Arab states.
Saudi foreign ministry on Saturday tok say dem no go accept "any infringement on di Palestinians' unalienable rights, and any attempts at displacement," as e accuse Israel of "ethnic cleansing".
Egypt don also reject any idea of to remove Palestinian population and say dem don call for emergency summit of di Arab League on 27 February to discuss wetin dem call "serious" Palestinian developments.
Wen BBC ask Israel President Isaac Herzog about Trump plan, e say time don reach for new ideas from US and Israel neighbours, Egypt and Jordan.
"We gatz find di right way to make sure say wetin happun on [7 October] no go happun again, wey mean say Hamas no go rule Gaza anymore," Herzog tell BBC Sunday wit Laura Kuenssberg programme.













