Peter Akpe take oath of office as Deputy govnor of Bayelsa state
Wia dis foto come from, Bayelsa State government
Di Chief Judge of Bayelsa State, Justice Matilda Abrakasa Ayemieye don swear in Dr Peter Pereotubo Akpe as di Deputy govnor of Bayelsa State.
Di swearing in ceremony happun inside di Executive Council chambers of di Bayelsa State Govment House, for Yenagoa di State capital.
E dey come afta di Bayelsa State House of Assembly confam Dr Peter Akpe as di new Deputy govnor designate of di state on Tuesday 24 February, 2026.
Justice Ayemieye as she administer di oath of allegiance and oath of office say di Deputy Govnor don fulfill all di requirements by law as e dey Section 19 subsection 3 of di 1999 constitution as amended.
Bayelsa State govnor Douye Diri as e welcome and give charge to di new deputy governor say e dey sure say dem go work togeda to sustain and deepen di progress dem don already make for di state and call on pipo of di state to support am.
Govnor Douye Diri bin nominate Akpe shortly after di burial of di late former deputy govnor Lawrence Ewhrudjakpo on January 30, 2026, for im hometown, Ofoni, Sagbama Local Govment Area of Bayelsa State. E die on 11 December, 2025 afta e collapse for office.
Bifor dis elevation to be di Deputy govnor, e bin be di Chief of Staff to govnor Douye Diri.
Peter Akpe come from Ebedebiri Federated Community for Sagbama Local Govment Area of Bayelsa State.
Wia dis foto come from, Bayelsa Govt New Media
Who be Peter Akpe
Dr Akpe na ordained clergy by di Redeemed Christian Church of God (RCCG), and im career cover both di civil service and politics as e don serve for di Rivers and Bayelsa state civil services before e join politics.
For im political career, Akpe don serve as a two-term member of di Bayelsa state house of Assembly from 2011 to 2019, and serve as majority leader throughout im stay for di legislature.
E also serve as commissioner between 2008 and 2011 under Govnor Seriake Dickson administration.
Wit dis swearing in, Dr Akpe go be di sixth deputy govnor di oil rich state don get.
Top Tori
Informate me
Di one wey dem dey read well well
Content is not available