PSG go play Chelsea, Arsenal meet Bayer Leverkusen for Champions league round of 16 fixtures
Wia dis foto come from, Getty Images
Di draws for di 2026 season of di Uefa Champions League round of 16 don conclude dis Friday and e throw up interesting matches.
No two English Premier League teams go meet dia sef for dis round, wich mean say e still dey possible for all di six EPL teams for di tournament to qualify for di quarterfinal.
No doubt di ogbonge tie for dis round na between Manchester City and Real Madrid while Chelsea go meet last season champions Paris Saint Germain.
Di prayers of Nigeria striker Victor Osimhen no work as im club Galatasaray go face Liverpool. Osimhen bin tell tori pipo say e prefer to avoid Liverpool, but e be like say im prayer no go work.
Tottenham go face Atletico Madrid wia anoda Nigeria striker Ademola Lookman don settle well since im transfer dis January.
Newcastle get ogbonge mountain to climb as dem face La Liga leaders Barcelona, while EPL leaders Arsenal go dig am out against former Bundesliga champions Bayer Leverkusen.
For di oda draws, Bodo Glimt, wey be di surprise team for dis season Champions League, go fancy diasef say dem go fit Sporting CP of Portugal. Di Norway club don already record wins against top European clubs like Man City and Atletico Madrid bifor dem beat last year finalists Inter Milan home and away for di round of 16 play offs.
Atalanta, di only Italian club wey remain for di tournament go face free-scoring Bayern Munich.
Di dates for di round of 16 na; 10 and 11 March for di first leg, and 17 and 18 March for di second leg.
Round of 16 fixtures
January signings fit play?
Players wey sign for di January transfer window dey eligible to play for di Champions League knockout phase.
Dis mean say Manchester City go fit play dia new signings Marc Guehi and Antoine Semenyo and Tottenham go fit play Conor Gallagher wey dem sign newly from Atletico Madrid.
Mamadou Sarr also dey eligible to play for Chelsea afta dem recall am from im loan move to Strasbourg of France.
However, di clubs gatz register dia new players for dia Champions League 'A list' bifor di knockout play-offs in order for dem to fit participate.
Quaterfinal, semifinal fixture dates
Quarter-finals: 7 and 8 April - first leg; 14 and 15 April - second leg
Semi-finals: 28 and 29 April - first leg; 5 and 6 May - second leg
Final: 30 May
Di final go hapun for di Puskás Aréna for Budapest, Hungary.
Top Tori
Informate me
Di one wey dem dey read well well
Content is not available